Library · pcm

Isaiah 53

53:1 “Na who go bilive di message wey wi dey hear naw? Na who don si God hand for dis matter before? 53:2 My savant grow like seed wey dem plant for dry groun. E nor even get beauti or respet wey go make us notis am. 53:3 Pipol rijet am and dem nor like am at-all. E bear sofa and pain well-well. Nobody even sorry am and wi trit am like sey e nor mean anytin. 53:4 But E bear di sofa and pain wey suppose bi awa own. But wi tink sey en sofa na di ponishment wey God gi-am. 53:5 But dem wound am bikos of awa sin; dem beat am bikos of di bad tins wey wi do. Na di ponishment wey e sofa give us peace and en wounds don make us well. 53:6 All of us bi like sheep wey don lost and wi dey waka go awa own way. But God gi-am di ponishment wey suppose bi awa own. 53:7 Dem trit and ponish am anyhow, but e put body down kon bear-am like lamb wey dem won go kill and e nor tok anytin. 53:8 Dem arrest and sey make dem kill-am and nobody kare about am. Dem kill-am, bikos of awa sins. 53:9 Even doh e nor do any bad tin or tok lie, dem plan to put am for grave with wiked pipol but dem kon beri am for rish man grave.” 53:10 Na God wont make e sofa and en deat na sakrifice, so dat God go forgive pipol dia sins. So en days go long and e go si en shidren-shidren and thru am, God go do wetin E wont. 53:11 But wen e si all di good tins wey en sofa bring, belle go sweet am. My savant wey I like well-well, go bear plenty pipol ponishment and I go forgive dem bikos of am. 53:12 So, I go honor and put am for where great men dey, bikos na only en sakrifice en life and dem si am as sina too. E karry evribody sins for en head kon pray so dat God go forgive us.