Library · pcm

Isaiah 56

56:1 God dey tell en pipol, “Make una do wetin dey good and korrect, bikos I go soon kom save una. 56:2 I go bless pipol wey always dey keep di Sabat Day and obey di kommand. I go bless doz wey nor dey do wiked tins.” 56:3 Strenjas wey dey follow una woship, make dem nor sey “God nor go ever take us as en pipol.” And man wey nor fit sleep with woman, make e nor sey, “My own don finish for dis life bikos I nor go ever fit born pikin.” 56:4 God dey tell dat kind man sey, “If yu honor and keep di Sabat Day; kon do wetin I wont and keep my kovenant, 56:5 I go remember una name for my temple and among my pipol and dat one betta pass any shidren wey una go fit get and una name go dey forever.” 56:6 God dey tell di strenjas wey join en pipol, doz wey love and dey serve am well; wey dey keep di Sabat Day and dey faithful as dem dey keep en kovenant sey: 56:7 “I go bring una kom Zion wey bi my holy hill kon give una joy wen una enter my prayer house, den I go asept di sakrifice wey una go offa for my altar. Dem go koll my temple, ‘Prayer house’, for all di nashons.” 56:8 God wey get pawa, wey bring Israel en pipol kom back from Babilon, don promise sey E go bring odas kon join dem too. 56:9 God don tell di oda nashon make dem kom like wiked animals kon skata en pipol. 56:10 E sey, “All di leaders wey suppose warn my pipol, dey blind! Dem nor know anytin. Dem bi like dog wey nor dey bark; dem just liedan dey dream. Make una si as dem like sleep well-well! 56:11 Dem bi like wiked dogs wey nor-tin dey satisfy. Dis leaders nor dey undastand at-all. All of dem dey do as dem like. 56:12 Dem go sey, ‘Make wi buy some wine and drink as wi like! Tumoro go betta pass today and wi go get evritin wey wi wont!’ ”