Jeremiah 37
37:1 King Nebukadnezzar for Babilon kon put Zedekaya wey bi Josaya pikin, as king for Judah, instead of Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin.
37:2 But King Zedekaya, en ofisas and di pipol nor gri obey di message wey God send mi.
37:3 So King Zedekaya send Jehucal wey Shelemaya born and Priest Zefanaya wey bi Maaseaya pikin sey make dem kom tell mi make I pray make God kom help awa pipol.
37:4 By dat time, dem neva put mi for prison and I still dey free to waka as I like for di town.
37:5 For dat time, Babilon sojas surround Jerusalem, but wen dem hear sey Egypt pipol don cross dia boundary dey kom, dem kon go back.
37:6 Den Israel God tell mi,
37:7 “Make yu tell Zedekaya wey sey make yu pray make I help dem sey, ‘Egypt sojas wey bin dey kom help yu, go-go back to dia town wen dem don help yu finish.’
37:8 But leta, Babilon pipol go kom back kon attack, seize and burn dis town rish groun.
37:9 So mi wey bi God dey warn una naw sey, make una nor deceive unasef sey Babilon sojas nor go kom back kon attack una, bikos dem go really kom back.
37:10 Even if una kill Babilon sojas well-well and na only di men wey una wound remain, dem go still kom burn dis town rish groun.”
37:11 Dis na wetin happen wen Babilon sojas leave Jerusalem, bikos Egypt sojas dey kom.
37:12 From Jerusalem, I kon go Benjamin town, so dat I go get my own part for awa family propaty.
37:13 But wen I rish Benjamin Gate, Irijah wey Hananaya pikin Shelemaya born wey bi di guards oga kon stop mi dey sey, “Na Babilon sojas send yu kom spy dis land!”
37:14 So I ansa, “No o-o! I nor dey spy for Babilon sojas o-o.” But Irijah nor gri listin to mi, so e arrest mi kon take mi go meet di ofisas.
37:15 Dem vex for mi well-well kon orda sey make dem beat and lock mi for Jonatan, di kourt seketry house wey dem turn to prison.
37:16 Dem put mi for undagroun prison and I tey well-well for der.
37:17 Afta, King Zedekaya sey make dem koll mi kom, den e take mi go korna kon ask, “God give yu any message for us?” I ansa, “Yes! E give mi.” Den I sey, “Babilon king go kom katch and karry yu go.”
37:18 Den I ask am, “Wish crime I kommit against yu, yor ofisas and di pipol, wey make una put mi for prison?
37:19 Wetin happen to yor profets wey sey Babilon king nor go attack yu or dis town?
37:20 But naw my oga, make yu listin to mi kon do evritin wey I dey beg yu. Make yu nor let mi go back to dat prison wey dey Jonatan house. Bikos if yu send mi go back, I go die for der.”
37:21 So, King Zedekaya kon sey make dem lock mi for di kourtyard wey dey di palis. I stay for der and evriday, dem dey give mi bread chop, until all di bread for di town finish.