Lamentations 3
3:1 I bi one pesin wey know wetin e mean wen God ponish yu.
3:2 E don porshu mi and naw I dey waka for darkness.
3:3 Evritime, na only mi E dey always ponish.
3:4 E don make my skin and flesh old kon break di bones for my body.
3:5 Na sofa and wahala E pak full my life.
3:6 Even doh I neva die, E beri mi for darkness like pesin wey don die.
3:7 E don tie mi with shain like prisona wey nor get hope to eskape.
3:8 I kry well-well make E help mi, but God nor gri ansa mi.
3:9 E use big-big stones take block evriwhere wey I dey pass and I nor know di rite road again.
3:10 To mi, E hide like bear or lion wey dey wait to attack pesin.
3:11 E drag mi komot for road; tear mi to pieces kon leave mi and nobody dey to help mi.
3:12 E set en arrow to take shot mi die
3:13 and naw, E don shot mi and di arrow enter my heart.
3:14 I don turn pesin wey pipol dey laf and sing yeye song for.
3:15 Na bitterness and sofa bi di food and drink wey God dey give mi.
3:16 E don use my face rub groun kon break my tit with stone.
3:17 I nor know wetin peace mean again and I don forget as happiness dey bi.
3:18 Den I kry kon sey, “I nor get respet again! I don lost evritin wey I hope to get from God!”
3:19 Wen ever I remember as I take sofa without house to sleep, e dey pain mi like poizin for my belle.
3:20 I nor go ever forget di time wen I take sofa; wen I bin dey mourn, bikos of evritin wey I lost.
3:21 Anytime I remember all dis tins, I know sey I still get hope.
3:22 God faithful love nor dey end! And en mesi nor dey finish.
3:23 Wi dey always trust Yu bikos na evriday Yu dey show us yor goodness.
3:24 I tell mysef sey, “Na only God I get, so I go trust only en.”
3:25 God dey good to pipol wey trust and dey find am.
3:26 So e betta make wi sidan kwayet kon wait until God go kom save us.
3:27 And na naw wey wi still dey yong, wi suppose learn how to get patient as wi dey wait for God.
3:28 Make wi sidan kwayet wen God dey deal with us.
3:29 Make wi bow face groun, may bi na den God go give us hope again.
3:30 Pesin wey dem slap for one side, make e turn di oda side. Make e nor tok wen en enemies dey curse am.
3:31 Bikos God nor go forget us forever.
3:32 Even doh sey E dey make us sofa naw, E still dey sorry for us, bikos en great love for us nor dey end.
3:33 God nor like to sofa pipol or make dem kry.
3:34 So to dey opress pipol for dis world,
3:35 to shit pipol kon kollect wetin bi dia own, God wey dey heaven dey si evritin
3:36 and E know dey happy wen dem nor give pesin korrect judgement for kourt.
3:37 So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?
3:38 Nor bi from God mout evritin from kom? Both good and bad?
3:39 Den, why wi human being go dey komplain if dem ponish us for awa sins?
3:40 Instead, make wi shek and test di tins wey wi dey do kon turn from sin kom meet God.
3:41 Make wi lift awa hand and heart to God for heaven kon sey,
3:42 “Wi don sin and go against Yu and na dis make Yu dey vex for us.
3:43 Yu don hide yorsef bikos Yu dey vex and Yu porshu us komot for yor front. Yu nor even pity for us wen Yu dey kill us.
3:44 Yu hide yorsef for di kloud, so dat awa prayers nor go rish where Yu dey.
3:45 Yu don make us bi like dirty rag for all di oda nashons front.
3:46 All awa enemies dey tok bad against us.
3:47 Wi dey fear, bikos wi dey trap; wi don konfuse and distroy awasef.
3:48 Wota dey rush kom out from my eye, bikos dem don distroy my pipol finish.
3:49 I still dey kry well-well and I nor go stop at-all
3:50 until God go look from heaven kon si wetin don happen.
3:51 My heart heavy well-well wen I si wetin happen to di wimen for dis town.
3:52 Pipol wey I nor do bad to, set trap for mi like sey I bi bird.
3:53 Dem trow mi inside one pit kon dey drop stone for my head.
3:54 Dem dey pour wota put for my head and I tink sey na die I dey.
3:55 But from inside di deep pit, I kon koll Yu wey bi my Oga God.
3:56 Yu hear my kry for help wen I sey: ‘God make Yu listin to mi well-well!’
3:57 Yes! Wen I koll Yu, Yu kom tell mi sey, ‘Nor fear.’
3:58 Oga God, na Yu bi my lawyer, so make Yu judge my kase, bikos Yu don save my life.
3:59 Yu don si di bad-bad tins wey dem do mi. So my God, make Yu judge my kase, so dat pipol go know sey I dey rite.
3:60 Yu don si all dia plans to revensh mi.
3:61 Yu don hear all di wiked names wey dem dey koll mi and Yu know all di plans wey dem don make.
3:62 Evriday, my enemies dey tok as dem dey plan against mi.
3:63 Si dem! Weda dem sidan or stand, na mi dem dey laf and take dey sing.
3:64 So Oga God, make Yu pay dem back for all di bad tins wey dem don do.
3:65 Make Yu give dem sturbon and strong heart, so dat yor curse go dey dia head.
3:66 So as Yu dey vex, make Yu porshu and distroy dem komot dis world.”