Library · pcm

Lamentations 5

5:1 Awa God, make Yu tink about dis tins wey dey happen to us naw and how awa enemies don disgrace us rish. 5:2 Strenjas don take all wetin wi get and na dem dey stay for awa town naw. 5:3 Wi don turn shidren wey nor get papa and awa mama don turn who en husband don die. 5:4 Wi must pay money to drink awa own wota and buy awa own firewood too. 5:5 Dem really dey porshu us and naw, wi don taya, but wi nor fit rest at-all. 5:6 Wi don make agriment with Egypt and Assyria pipol, so dat wi go get enough food to chop make honga nor for kill us. 5:7 Na awa grand-grand papa dem sin and dem don die, but naw, wi dey sofa dia ponishment. 5:8 Doz wey bi awa slave before, don turn awa oga naw and nobody dey to save us from dia pawa. 5:9 Wi dey risk awa life as wi dey find food wey wi go chop, bikos tif many for di towns and di village dem. 5:10 Awa skin hot like oven and na honga make us dey sick so. 5:11 Enemies don rape awa wifes for Jerusalem and dem don disgrace awa yong girls for Judah town. 5:12 Dem hang and kill di kings family kon trit awa eldas anyhow. 5:13 Dem karry awa yong men go do strong work and awa boys dey stagga, bikos of di heavy wood wey dem dey karry. 5:14 Awa eldas nor fit sidan for di town gate again and di yong men nor dey dance and sing again. 5:15 Joy nor dey awa heart again bikos wi wey bin sabi dance, don turn who dey mourn naw. 5:16 Awa crown don fall komot from awa head, bikos wi don sin and naw, wi dey sofa. 5:17 Bikos of dis, wi dey feel pain and wi nor dey si well again; awa eyes don dey weak, bikos wi don kry taya. 5:18 Mount Zion don empty and nobody dey der again, so naw, na wild animals dey stay der. 5:19 So Yu my Oga God, go rule forever and ever! Yor throne go dey from one generashon go rish anoda one. 5:20 But why Yu forget us like dis and wetin make Yu leave us since? 5:21 My Oga God, make Yu save and take us back as yor own! Make Yu give us di happiness wey wi get before. 5:22 Abi Yu don rijet us forever? Yu go kontinue to dey vex for us?