Library · pcm

Ezekiel 17

17:1 God kon tell mi: 17:2 “Man pikin, go tell Israel pipol dis parabol; 17:3 tell dem sey di Oga God wey get pawa well-well sey: “One big eagle wey get fine and long feadas, fly go Mount Lebanon kon break di branches wey high pass for one cedar tree komot, 17:4 den e karry am go where pipol for dey do business kon plant am for der. 17:5 E take one small plant for Israel kon go plant am for betta groun and wota dey always dey di place so dat e go grow. 17:6 So di plant grow kon spread for evriwhere like grape tree. Di branches dem grow well-well and en rut strong for groun too. E kon turn to big vine tree wey get many branches and leaf. 17:7 Anoda strong eagle wey get big and tick feada dey. Naw, di rut and leaf for di vine face dis eagle, bikos di vine bilive sey di eagle go gi-am more wota pass di one wey di gardin dey give, 17:8 even doh dem don already plant di vine for betta groun wey get wota, wey go make am grow well kon bear betta and sweet fruits. 17:9 Naw, mi God wey get pawa dey ask: Dis vine go prosper? No! I go plok all en fruit kon rut am komot groun and en leaf go dry kon die. I nor nid strong hand or many pipol, bikos e nor go hard mi to rut am from groun. 17:10 Yes, dem don plant am, but e go fit prosper? E nor go die wen breeze blow kom from east? Abi e nor go dry finish for where e for dey grow?” 17:11 God tell mi, 17:12 “Ask dis bad pipol if dem know wetin di parabol mean. Tell dem sey Babilon king kom katch and karry Jerusalem king and en ofisas go Babilon. 17:13 E choose one of Jerusalem king broda, enter agriment with am kon make am swear sey e go always dey loyal to am. E katch and karry important pipol go prison, 17:14 so dat Jerusalem nor go raiz again and to make sure sey dem go keep di agriment wey dem make with am. 17:15 But Judah king go against Babilon king. E go hire horse and many sojas from Egypt. Naw, with all dis one, e go fit win di fight against Babilon king? E go fit do wetin e plan? E go fit break di agriment and nobody go ponish am? 17:16 “As long as I bi God wey nor dey die, dis king go die for Babilon, bikos e break di agriment wey e make with Babilon king wey put am for di throne. 17:17 Wen Babilon sojas don ready to attack and kill pipol, even di sojas wey strong pass for Egypt nor go fit help Judah king, tok-less of to save am, 17:18 bikos e don break di agriment wey e make. E do all dis tins and naw, e nor go eskape am.” 17:19 So God wey get pawa sey, “As long as I bi di God wey nor dey die, I go ponish am, bikos e break di agriment wey e make with my name. 17:20 I go katch am with my net. I go take am go Babilon kon ponish am for der, bikos e disobey mi. 17:21 Dem go kill en betta-betta sojas for war and di ones wey survive go skata for evriwhere. Den e go know sey, Mi, wey bi God, don tok.” 17:22 Dis na wetin God dey tok: “I go kut di branches wey high pass for di cedar tree komot, den I go plant am on-top mountin 17:23 and na on-top di mountin wey high pass for Israel. E go grow kon get branches; bear seed and e go bi very fine cedar. Difren birds go stay der kon build house put for di cedar tree. 17:24 Evry tree for di land go know sey na mi bi God. I go kut di trees wey tall and di ones wey short, I go make dem tall. I go make green trees dry kon make dry trees, green. Mi wey bi God don tok and I go do wetin I sey I go do.”