Ezekiel 19
19:1 God sey make I sing dis sorrowful song for di prince dem wey dey Israel:
19:2 “Una mama na really strong lion wey train en shidren for where oda wiked lions dey.
19:3 E tish one among en shidren how e go take katch oda animals and naw, e dey chop human being.
19:4 But pipol for oda nashons hear about am, so dem tie and trow am inside pit kon drag am with hook go Egypt.
19:5 Wen di mama wait kon si sey en pikin nor dey kom back again, e kon train anoda lion wey wiked pass di first one.
19:6 Wen dat one don big, e kon start to katch animals and chop human being like oda lions.
19:7 E skata where sojas dey guide well and distroy dia towns. Di way e dey shaut, dey make di pipol for di land dey fear.
19:8 Pipol gada kom from evriwhere kon fight am. Dem spread dia net kon katch am with dia trap.
19:9 Den dem put am for kage kon karry am go give Babilon king. Dem put am for prison, so dat pipol nor go hear en vois again on-top Israel mountin.
19:10 Yor mama bi like vine wey dem plant near wota wey get fresh leaf and dey bear good fruits.
19:11 En branches strong well-well like royal rod. Di vine grow and tall well-well. Yes! Evribody si as e tall rish and how en leaf fine.
19:12 But wiked pipol kon kut am down. Di wind blow kon dry all en fruit. En branches dem break komot kon dry and fire burn dem.
19:13 Naw, dem plant am for desert; di place wey dry and nor get wota.
19:14 Den fire katch di vine kon burn evritin plus en fruit finish and e nor go ever strong again. E nor go ever bi dat royal rod again. “Dis na di sorrowful song wey dem go always dey sing.”