Daniel 1
1:1 For di third year wey King Jehoiakim dey rule for Judah, King Nebukadnezzar for Babilon kon attack Jerusalem.
1:2 God allow King Nebukadnezzar katch King Jehoiakim and e karry some of di tins wey dey God temple too. E karry Judah pipol as prisonas go Babilon and di tins wey e karry from Jerusalem, e put dem for en own juju temple.
1:3 Den di king kommand Ashpenaz wey dey guide di kourt sey make e choose some Israel men wey kom from royal house and from betta family:
1:4 yong men wey nor get any diziz for body; wey fine; wey dem don train and wey go fit learn kwik-kwik, so dat dem go dey serve and work for di king palis. E still sey make Ashpenaz tish dem di language and evritin for Babilon.
1:5 Di king still orda sey make dem give dem di same food and wine wey en and di oda pipol dey chop and drink evriday. E sey dem go train dem for three years and afta di three years, dem go kom serve di king.
1:6 Di pipol wey dem choose from Judah na: Daniel, Hananaya, Mishael and Azaraya.
1:7 But di pesin wey bi guide di kourt kom shange dia names. E give Daniel, Belteshazzar; Hananaya kon bi Shadrak; Mishael kon bi Meshak and Azaraya kon bi Abednego.
1:8 But Daniel kon decide sey e nor go chop di sweet food and wine wey dem dey serve for di king palis, bikos e nor won dey unklean. So e beg di pesin wey dey lead dem sey, en nor won chop di royal food or drink di wine.
1:9 So God kon make Ashpenaz mind soft and e gri with wetin Daniel tell am.
1:10 So e tell Daniel, “I dey fear my masta di king. Na-im tok di kind food wey una go chop and wine wey una go drink; wot of if e sey yu dey tin and di oda yong men dey fat! Wetin I go tell am?
1:11 Den Daniel go meet di pesin wey Ashpenaz sey make e dey guide en, Hananaya, Mishael and Azaraya kon tell am:
1:12 Abeg make yu test yor savants for ten days. Just give us vegitabol make wi chop and wota make wi dey drink.
1:13 Afta di ten days, make yu kompare us with di odas wey dey chop and drink di king food and wota; den yu go judge us with wetin yu si.”
1:14 Di pesin wey dey guide dem so kon gri with wetin e tok and e test dem for ten days.
1:15 Wen ten days don finish, dia body betta and dem get flesh pass di yong men wey dey chop and drink di royal food and wine.
1:16 So di pesin wey dey guide dem kon remove di royal food and wine wey di king sey make dem chop, den dem kontinue to chop dia vegitabol and drink wota.
1:17 God kon give dis four men good sense; difren gift and wisdom. God give Daniel di gift to take tell pipol wetin vishon and dreams, mean.
1:18 Afta three years, Ashpenaz kon take all di yong men go meet King Nebukadnezzar.
1:19 Den di king follow dem tok. E nor si anybody wey bi like Daniel, Hananaya, Mishael and Azaraya. So dem kon bi memba for di king kourt.
1:20 Any matter wey koncern wisdom and knowledge wey di king ask dem, e dey si sey dia ansa betta well-well pass di ansa wey all di wise men, majik pipol and di pipol wey dey tok wetin go happen for future, dey give.
1:21 Daniel stay for di royal house until di first year wen King Cyrus start to rule.