Library · pcm

Daniel 10

10:1 For di third year wen King Cyrus for Persia dey rule, God kon give Daniel (wey dem dey koll Belteshazzar) one message. Dis message na true, but e hard to undastand. Daniel undastand di message thru di vishon wey e si. 10:2 Before dat time, mi, Daniel dey mourn for three weeks. 10:3 I nor chop any good food, meat, drink wine or komb my hair until di three weeks komplete. 10:4 For di twenty fourt day for di first mont, I stand near di great river, wey dem dey koll Tigris. 10:5 I look up kon si one man wey wear linen klot: di belt for en waist na gold wey dem make from Ufaz. 10:6 En body bi like yellow jasper and en face dey shine like lite. En eye dey shine like tosh; en hand and leg bi like bronze wey dem polish. En vois alone bi like sey na many pipol dey tok. 10:7 Na only mi, Daniel si di vishon. Di men wey follow mi nor si am. Dem run go hide, bikos dem dey fear. 10:8 Na only mi dey der wen I si dis great vishon. I nor get strent again and my face kon shange well-well and anybody wey si mi nor go know sey na mi. 10:9 But I hear as e dey tok and wen I hear dis vois, I just fall face groun. 10:10 Den one hand tosh and karry mi stand up well; but I still dey shake. 10:11 Di angel kom tell mi, “Daniel! God love yu. Stand up make yu listin well-well to wetin I won tok naw, bikos na God send mi kom meet yu.” Wen e don tok finish, I kon stand up, even doh I still dey shake. 10:12 Di angel tell mi, “Daniel, make yu nor fear. Since di first day wen yu honbol yorsef kon dey pray for undastandin, naim God don ansa yor prayers. So I kom as ansa to all yor prayer. 10:13 Di prince for Persia kingdom oppoz mi for twenty-one days. But Mikael, one strong angel for heaven kom help mi, bikos na only mi dey Persia. 10:14 Naw, I don kom help yu undastand wetin go happen to yor pipol for di future, bikos dat na wetin di vishon dey tok-of.” 10:15 As di angel still dey tok to mi, I sleep for groun and I nor fit tok. 10:16 Den di angel wey bi like human being, appear kon tosh my lip. I open my mout kon start to tok. I tell am, “Oga God! Dis vishon don make mi weak and na-im make mi dey shake anyhow. 10:17 I bi like savant wey stand for en oga front. Naw, how I won take tok to yu? I nor get strent to even breath again.” 10:18 Den di angel tosh mi again and my body kon strong. 10:19 E sey, “Make yu nor fear, God love yu well-well! So nor let anytin worry yu. Make yu dey strong! Wen e don tok like dis, my body kon strong more-more.” Den I sey, “Oga! Yu don make mi dey okay naw.” 10:20 Di angel sey, “Yu know wetin make mi kom meet yu? Naw, I won go fight Persia prince. Wen I don go, di angel wey dey guide Greece go kom. 10:21 “But I go first tell yu wetin dem rite for di book wey yu fit trust. (Nobody fit help mi against di prince, escept Mikael wey dey guide Israel.