Library · pcm

Hosea 11

11:1 “Na since wen Israel bi small pikin I love am and I kon koll am komot from Egypt. 11:2 But di more I dey koll am, di more e dey waka far from mi kon dey do sakrifice and burn incense give juju. 11:3 Na mi tish Efraim how to waka. I karry my pipol for my hand, but dem nor know sey I kare for dem. 11:4 I draw dem near body with love and kindness. I remove dia heavy load from dia head kon bend down feed dem by mysef. 11:5 But dem nor gri kom back kon meet mi and bikos of dat, dem must go back to Egypt and Assyria pipol go rule dem by force. 11:6 War go kom dia towns kon break and skata dia gates. Enemies go distroy my pipol for where dem tink sey nor-tin go fit happen to dem. 11:7 Dem don gri sey dem nor go turn kom meet mi. Dem koll mi wey bi di Most High God, but I nor go raiz dem up at-all. 11:8 Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong. 11:9 I nor go ponish una, bikos I dey vex; I nor go distroy Efraim again, bikos I bi God and I nor bi man. Mi wey dey holy, dey with una. I nor go vex kom meet una. 11:10 I go shaut like lion kon fight my pipol enemies, den my pipol go follow mi. Dem go rush kom meet mi from west. 11:11 Dem go rush kom from Egypt like bird and from Assyria like dove. I go bring dem kom back to dia town again. Mi, wey bi God, don tok.” 11:12 Israel pipol surround mi with lie-lie; na wayo full Efraim, but Judah pipol still trust and dey faithful to God wey dey holy.