Hosea 2
2:1 Den make yu go koll yor brodas, “Ammi” (wey mean “My pipol”)! And yor sistas, “Ruhamah” (wey mean “Pity”)!
2:2 Make yu akuiz yor mama, Israel, bikos e nor bi my wife again and mi Oga God, nor bi en husband again.
2:3 If e nor gri stop, I go naked am, just as e bi wen dem born am. I go make am bi like dry land, where nor-tin dey grow and I go let wota hongry am till e die.
2:4 I nor go pity or sorry for en shidren, bikos na ashawo wey nor get shame, born dem.
2:5 Dia mama sey, “I go-go meet my lovers, bikos na dem dey give mi food, wota, wool, linen, olive oil and wine.”
2:6 But I go fence and block una mama with shuku-shuku, so dat e nor go waka go anywhere.
2:7 E go run follow en lovers, but e nor go fit katch dem. E go find dem, but e nor go si dem. Den e go sey, “I go-go back to my first husband. I betta well-well den wen I dey with am, pass as I dey naw.”
2:8 But till naw, e nor ever gri sey na mi gi-am di korn, wine, olive oil and all di silva and gold wey e take dey woship Baal.
2:9 So for harvest time, I go take all my gifts wey bi korn, wine, wool and linen wey I gi-am make e wear.
2:10 I go naked am for en lovers front and nobody go fit save am from my pawa.
2:11 I go stop all di party and feast wey e dey do evry mont, year and for Sabat Day.
2:12 I go distroy all en vine and di fig tree wey e sey en lovers gi-am, bikos e dey serve dem. I go turn en gardins to wildaness; den wiked animals go distroy dem.
2:13 I go ponish am for all doz times wey e forget mi kon dey burn incense give Baal and dey run follow en lovers with all di gold wey e wear. Mi, wey bi God, don tok.
2:14 I go karry am go wildaness kon make am turn kom meet mi with di sweet-sweet words wey I go tell am.
2:15 I go gi-am back en vineyard den Trobol Valley go kon bi Hope Valley. E go ansa mi for der, just as e do wen e dey yong for di time wen e dey komot from Egypt.
2:16 For dat time, na husband yu go dey koll mi instead of yor masta.
2:17 I go remove Baal name from yor mout and yu nor go ever take about am again.
2:18 For dat time, I go make kovenant with all di wild animals and birds, so dat dem nor go wound my pipol. I go still take di tins wey dem take dey fight war komot from di land kon let my pipol stay for peace.
2:19 Israel, I go make yu my wife; I go love and dey faithful to yu; I go always sorry for yu and yu go bi my own forever.
2:20 I go keep my promise kon make yu my own, den yu go know sey na mi bi yor God.
2:21 For dat time, wen my pipol Israel pray to mi, I go ansa dem.
2:22 I go make rain fall and korn, grape and olive fruit go grow for di land.
2:23 I go make my pipol stay for di land and dem go prosper. Doz wey dem dey koll “No-pity” before, I go pity for dem and doz wey dem dey koll “Nor bi my pipol,” I go sey, “Naw, una don bi my pipol”, den dem go ansa sey, “Na Yu bi awa God.”