Library · pcm

Leviticus 13

13:1 God tell Moses and Aaron: 13:2 “If anybody get sore, boil or spot and e turn to diziz for en skin, dem must karry am go meet Aaron wey bi di priest or en sons. 13:3 Di priest go look di sore and if di hair wey dey en skin don turn white and di sore deep well-well pass di skin, di priest go sey di pesin nor dey klean. 13:4 “But if di sore dey white and e nor deep pass di skin and di hair neva shange to white, di priest go separate di pesin from oda pipol for seven days. 13:5 Di priest go look am again for di sevent day and if e feel sey di sore still bi as e bi before, e go separate am for anoda seven days. 13:6 Di priest go look am again for di sevent day and if di sore don dey go, e go kon sey e dey klean; bikos na only sore e get. Di pesin go wosh en klot and e go dey klean. 13:7 But if di sore spread afta di priest don look am sey e klean, e must go meet di priest again. 13:8 Di priest go look am again and if e si sey e don spread, e go sey e nor dey klean, bikos na diziz e get. 13:9 “If anybody get diziz for en skin, dem go take am go meet di priest and 13:10 e go look am. If white sore dey di skin wey turn di hair to white and e get plenty pus, 13:11 na sirious diziz e get for en skin. Di priest go sey e nor dey klean. 13:12 “If di diziz for di skin spread kover all en body, 13:13 di priest go look am again. If e si sey e don really kover en whole body, e go kon sey di pesin klean. If all en skin turn to white, den e dey klean. 13:14 But if new sore bigin show, den e nor dey klean. 13:15 Di priest go look am again and if e si new sore wey open for en skin, e go sey e nor dey klean. Sore wey open mean skin diziz wey fit kill pesin. So di pesin nor dey klean at-all. 13:16 But wen di sore don heal and e don turn white back, di pesin go-go meet di priest, 13:17 wey go look am again. If di sore don turn white, den di priest go sey e don klean. 13:18 “If anybody get boil wey don heal, 13:19 den di boil kon swell-up and white or red-white spot kon appear for where di boil dey before, e go-go meet di priest. 13:20 Di priest go look am and if di spot deep pass di skin wey near where di boil dey and di hair dem wey dey der kon turn white, e go sey di pesin nor dey klean. Na skin diziz wey dem dey fear well-well. 13:21 If di priest look am kon si sey di hair wey dey der neva turn white and e nor deep pass di skin, but e get lite kolour, di priest go separate di pesin from oda pipol for seven days. 13:22 If di spot spread, di priest go sey di pesin nor dey klean; e get diziz. 13:23 But if e nor shange or spread and na only di mark dey show, di priest go sey e dey klean. 13:24 “Wen sometin like fire burn pesin, if di flesh shange to white or red-white, 13:25 di priest go look am. If di hair for di spot don turn white and e deep pass di skin wey dey near am, den dat na skin diziz wey pipol dey fear well-well and di priest go sey e nor dey klean. 13:26 But if di hair for where di spot dey turn white and e nor deep pass di skin wey dey near am, but e get lite kolour, di priest go separate am from oda pipol for seven days. 13:27 Di priest go look am again for di sevent day and if e dey spread, di priest go sey e nor dey klean. 13:28 But if di spot nor shange, spread and e get lite kolour, den nor bi skin diziz. Di priest go sey e dey klean, bikos na just mark from di fire wey burn am. 13:29 “Wen man or woman get sore for head or for di bear-bear side, 13:30 di priest go look am. If e deep pass di skin wey dey near am and di hair dem dey yellow and tin, den dat na skin diziz wey pipol dey fear well-well, so di priest go sey di pesin nor dey klean. 13:31 If di priest look am kon si sey di sore nor deep pass di skin wey dey near am and e nor get black hair, di priest go separate am from oda pipol for seven days. 13:32 Di priest go look di sore again for di sevent day, if e neva spread or yellow and e nor deep pass di skin wey dey near am, 13:33 den di pesin go barb en hair kon leave only di place where di sore dey. Di priest go separate am from oda pipol for anoda seven days. 13:34 For di sevent day, di priest go look di sore again and if e neva spread and e nor deep pass di skin wey dey near am, di priest go sey di pesin dey klean. So e go wosh en klot kon dey klean. 13:35 But if di sore spread afta di priest don sey e dey klean, 13:36 di priest go look am again. If di sore don spread, e nor nid to look for hair wey yellow; di pesin nor dey klean bi dat. 13:37 But if di priest feel sey di sore neva spread and black hair dey grow for inside, dat mean sey di sore don heal, den di pesin don klean. 13:38 “Wen man or woman get white spot for en skin, 13:39 di priest go look di pesin. If di white spot wey dem get for body na white wey don fade, den na rashes from di pesin skin and e dey klean. 13:40 “If man nor get hair for back of en head, e dey klean. 13:41 If man nor get hair for front of en head, e dey klean. 13:42 But if rashes wey dey red dey for di back or di front wey hair nor dey, den dat na diziz. 13:43 Di priest go look am, if di diziz na di one wey dey red and white for di back or for di front where hair nor dey, 13:44 den di man don get strong diziz bi dat. E nor dey klean. Di priest must sey di man nor dey klean, bikos of di diziz wey dey en back head. 13:45 “As for di pesin wey get di diziz, dem must tear e klot; nor komb en hair and e go kover en face dey shaut sey, ‘I nor dey klean! My body dirty well-well!’ 13:46 As long as e get dis diziz, e go dey unklean and una go keep am for where pipol nor dey-dey for outside di kamp. 13:47 “Wen klot get diziz, weda na wool or linen klot, 13:48 or any pieces of linen or wool, or di leda or anytin wey dem take leda make, 13:49 if di diziz wey dey di klot or leda na yellow wey dey green or red, den dem must show di priest. 13:50 Di priest go look di tins well-well kon keep am for outside for seven days. 13:51 E go shek am again for di sevent day. If di diziz don spread for di klot, wrapa or leda, den di klot nor dey klean bi dat. 13:52 Di priest go burn am with fire, bikos of di diziz wey spread for di klot. 13:53 “But wen di priest shek and di diziz neva spread for di klot, 13:54 e go sey make dem wosh and keep am for anoda seven days. 13:55 Den e go look am again, if di diziz neva shange kolour, even if e nor spread e go still dey unklean; den una must burn di klot, weda di stain dey for back or front. 13:56 But if di priest look kon si sey di diziz don fade, e go tear dat part komot for di klot or di leda. 13:57 Den if di diziz kom back kon spread again, di pesin wey get di klot go burn am. 13:58 If e wosh di klot and di spot dem komot, e go wosh am again and e go dey klean.” 13:59 Dis na di law about diziz wey dey inside klot, weda na wool, linen or leda and na like dis dem go take know weda e dey klean or not.