Library · pcm

Leviticus 15

15:1 Den God tell Moses and Aaron: 15:2 “Make una go tell Israel pipol sey, ‘Wen man discharge, e go dey unklean, bikos of dat tin. 15:3 Weda di tin dey komot from en body or e don stop, di man don dey unklean. 15:4 Any bed wey e liedan or sidan put, don dey unklean. 15:5 “ ‘Anybody wey tosh di bed wey di man liedan put must go wosh en klot kon baf with wota and di pesin go dey unklean till evening. 15:6 Anybody wey sidan for di chair wey di pesin wey discharge sidan put before, must wosh en klot, baf with wota and e go dey unklean till evening. 15:7 Anybody wey tosh am must go wosh en klot, baf and e go dey unklean till evening. 15:8 If di pesin wey discharge, spit for pesin wey dey klean body, dat pesin must go wosh en klot kon baf, but e go dey unklean till evening. 15:9 Anytin wey dem dey ride or chair wey di pesin sidan put go dey unklean. 15:10 Anybody wey tosh wetin e sidan put go dey unklean till evening. Anybody wey karry wetin di pesin sidan put must go wosh en klot, baf, but e go still dey unklean till evening. 15:11 Anybody wey tosh di man wey discharge and e nor wosh en hand, must go wosh en klot and baf with wota, but e go still dey unklean till evening. 15:12 If di man tosh klay pot, dem must break am and if na plate wey dem make with wood naim di man tosh, dem must wosh am. 15:13 “ ‘Wen di man wey discharge don klean, e go wait for seven days, wosh en klot kon baf with fresh wota and e go dey klean. 15:14 For di eight day, e go take two dove or two pijin kom di tent gate for God present kon give dem to di priest. 15:15 Di priest go offa one for sin ofrin and di oda one for burnt ofrin. Na like dis di priest go take make sakrifice for di man for God eye. 15:16 “ ‘Wen di man discharge, e must go baf, but e go dey unklean till evening. 15:17 Anytin wey dem do with klot or leda and di discharge tosh am, dem must wosh am and di tin go dey unklean till evening. 15:18 Afta di man don sleep with di woman finish, di man and di woman must go baf and dem go dey unklean till evening. 15:19 “ ‘Wen woman dey mestrate, e go dey unklean for seven days. Anybody wey tosh am go dey unklean till evening. 15:20 Anytin wey e sidan or liedan put wen e dey mestrate, go dey unklean. 15:21 Anybody wey tosh di bed wey e sleep put must wosh en hand kon baf, but e go dey unklean till evening. 15:22 Anybody wey tosh di chair wey e sidan put must go wosh e klot, baf with wota and e go dey unklean till evening. 15:23 If anytin dey for di bed or di chair wey e sidan put, wen e tosh am e go dey unklean till evening. 15:24 If man sleep with am for dat time, e go dey unklean for seven days and any bed wey di man sleep put, go dey unklean too. 15:25 “ ‘Wen di woman dey mestrate before di rite time or if di blood still dey flow wen e suppose don stop, e go dey unklean as far as di blood still dey flow. 15:26 Any bed wey e sleep or anytin wey e sidan put, go dey unklean for dat time. 15:27 Anybody wey tosh dem, dey unklean and e must go wosh en hand kon baf, but e go dey unklean till evening. 15:28 “ ‘Wen di blood don stop, di woman go wait for seven days, den e go dey klean. 15:29 For di eight day, e go take two dove and two pijin go give di priest for di tent gate for God present. 15:30 Di priest go offa one for sin ofrin and di oda one for burnt ofrin, na like dis di priest go take make sakrifice before God.’ ” 15:31 God tell Moses make e warn Israel pipol about dia dirty life, so dat dem nor go spoil God house wey dey di kamp centre. If dem do am, dem go die. 15:32 “Dis law na for men wey dey discharge, 15:33 woman wey dey mestrate or man wey sleep with woman wey nor klean.”