Leviticus 18
18:1 God tell Moses:
18:2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi di Oga una God.
18:3 Make una nor do wetin una do for Egypt where una dey before or for Kanaan land wey I go soon give una or do wetin dia law tok.
18:4 Una must always keep my law and do wetin I tok. Na mi bi di Oga una God.
18:5 So una must keep my law and kommandment; anybody wey do like dat, go get long life. Na mi bi God.
18:6 “ ‘Make nobody sleep with en family memba, bikos na mi bi God.
18:7 Make una nor sleep with una mama, bikos una don disgrace una papa bi dat. Di woman na yor mama, so yu must nor sleep with am.
18:8 Make una nor go sleep with una papa wife, bikos na una papa nakednes.
18:9 “ ‘Make una nor go sleep with una sista, weda na una papa or mama pikin; or weda dem born am for di same house or outside; una must not sleep with dem.
18:10 “ ‘Make una nor sleep with una grand-pikin, weda di girl na yor son pikin or yor dota pikin, bikos dis go make yu disgrace yorsef.
18:11 Make una nor sleep with una step sista, or di girl pikin wey una papa wife born, bikos di girl na yor sista.
18:12 Make una nor sleep with una papa sista; bikos na yor papa flesh, e bi.
18:13 Make una nor sleep with una mama sista, bikos na yor mama flesh, e bi.
18:14 Make una nor sleep with una papa broda wife kon disgrace di man, bikos di woman na una aunty.
18:15 Make una nor sleep with una pikin wife; bikos na una pikin wife e bi.
18:16 Make una nor sleep with una broda wife, bikos una go disgrace una broda.
18:17 “ ‘Make una nor sleep with both mama and dota. And make una nor sleep with di woman grand-pikin, weda na en son or dota born am. Dem bi klose family and dis tin dey wiked well-well.
18:18 “ ‘As long as yor wife dey alive, nor marry en sista as sekond wife kon sleep with am, bikos dem go hate demsef.
18:19 “ ‘Make una nor sleep with any woman wey dey mestrate.
18:20 “ ‘Make una nor sleep with anoda man wife, bikos e nor good and e go make una dey unklean.
18:21 “ ‘Make una nor give una pikin as ofrin to Molek juju, bikos e go disgrace Oga God name.
18:22 “ ‘Make man nor sleep with man as if na woman; bikos dat kind tin dey bad for God eye.
18:23 “ ‘No man or woman must sleep with any animal, bikos e go make dem dey unklean.
18:24 “ ‘Make una nor spoil unasef with dis tins, bikos di pipol wey I dey drive komot for una, don spoil demsef with all dis tins.
18:25 Di whole land don dey unklean and I don ponish dem for dia sin, so di land don rijet di pipol wey dey stay der.
18:26 Una must obey all my law and kommand and una nor go do dis evil tins, both Israel pipol and doz wey bi strenjas,
18:27 bikos di pipol wey dey di land before, don do all dis evil tins and di land don dey unklean.
18:28 Make una nor make di land rijet una, bikos una spoil am, just as e rijet di pipol wey dey der before.
18:29 If anybody do dis evil tin, di pesin wey do dem nor go dey among my pipol again.
18:30 Una must obey my kommand and nor do any evil wey dem do before, so dat una nor go spoil unasef with dem. Na mi bi di Oga una God.’ ”