Leviticus 21
21:1 God tell Moses: “Make yu tell di priest wey bi Aaron sons sey, ‘For pesin wey don die, make any priest nor go dirty ensef bikos e go di burial.
21:2 But if di pesin dey klose to am like en: mama, papa, sista, broda,
21:3 and en sista wey bi virgin wey nor get husband, e fit go.
21:4 E must nor dirty ensef for somebody wey rilate to am only thru marriage.
21:5 Make di priest nor barb any part for en head, shave en bear-bear or kut en body.
21:6 Dem must dey holy to dia God and nor disgrace my name, bikos na dem dey offa food ofrin to mi.
21:7 Bikos di priests dey holy, dem must nor marry ashawo or woman wey nor bi virgin or woman wey leave en husband.
21:8 Di pipol must si di priest as pesin wey dey holy, bikos na-im dey give di food ofrin to mi. I dey holy and I dey make my pipol holy.
21:9 If priest dota turn to ashawo, e dey bring disgrace for en papa; so dem go burn di girl.
21:10 “ ‘Wen dem don pour di anointin oil for High Priest head, e don dey klean to wear di garment wey priests dey wear and e must nor komb en hair or tear en garment.
21:11 E must nor go where dead body dey; e must nor make ensef unklean even for en papa or mama.
21:12 E must nor komot from di temple or enter where dead body dey, even if na en papa or mama die, bikos e don dey holy thru God anointin oil. Na mi bi Oga God.
21:13 Na only virgin di High Priest go fit marry.
21:14 E nor go marry woman wey en husband don die or wey leave en husband or woman wey dey do ashawo. En wife must bi virgin from en family.
21:15 If not, en shidren wey suppose dey holy go kon dey unklean. Na mi bi God and I don separate am as my High Priest.’ ”
21:16 God tell Moses:
21:17 “Go tell Aaron sey, ‘Make no man from en family wey get diziz, offa food ofrin to God.
21:18 Make nobody wey get diziz go offa food ofrin: dat is, doz wey blind, cripple, wey get sore or wey en body nor komplete;
21:19 man wey en hand and leg break;
21:20 man wey get hunch-back or man wey bi dwarf; man wey get diziz for eye or for en body and man wey nor gri marry.
21:21 Make nobody from Aaron family wey get diziz go offa food ofrin to God.
21:22 Di pesin fit chop di food wey dey holy well-well and di holy food wey bi God own,
21:23 but e nor go enter di holy curtain or kom near di altar, bikos e get diziz. So e nor go offa dis tins, bikos na mi bi God and I don make dem dey holy.’ ”
21:24 So dis na wetin Moses tell Aaron, en sons and all di pipol for Israel.