Zechariah 4
4:1 Den di angel wey bin dey tok to mi kom back kon wake mi just as dem dey wake pesin wey dey sleep.
4:2 E ask mi, “Wetin yu si naw?” I ansa, “Na one lampstand wey dem make with gold, wey get bowl where dem dey pour oil put. Seven lamps dey on-top di lampstand and each one get seven whole for di wick.
4:3 Two olive tree dey near di lampstand too; one for each side.”
4:4 Den I ask di angel wey tok to mi, “My oga, wetin dis tins mean?”
4:5 E ansa, “So yu nor know wetin all dis tins mean?” I ansa, “No o-o, my oga! I nor know.”
4:6 Den e tell mi, “Dis na wetin Oga God dey tell Zerubabel: ‘Nor bi with force or human being bin pawa, but na with my Spirit.’
4:7 “Even di strongest mountin nor go fit stand fight Zerubabel, bikos di mountin go turn ordinary groun for en front! And wen Zerubabel don put di final stone for where e suppose dey for di temple, di pipol go shaut, ‘Make God bless am! Make God bless di temple well-well!’ ”
4:8 Den God tell mi anoda message:
4:9 “Na Zerubabel start di temple foundashon and na-im go komplete am. Dat time, una go know sey na Oga God send mi kom.
4:10 Make una nor laf as una take start small, bikos God dey happy sey di work don start and E dey happy to si di ruler for Zerubabel hand.” (Di seven lamps na God eyes wey dey look di whole world.)
4:11 Den I ask di angel, “Na wetin bi dis two olive tree wey dey each side for di lampstand
4:12 and di two olive branches wey dey pour gold oil kom out from di two gold pipe?”
4:13 Di angel ansa, “So yu nor know wetin dem mean?” I ansa, “No o-o, my oga! I nor know.”
4:14 Den e tell mi, “Na dem bi di two pesin wey dem anoint for heaven to serve Oga wey bi God for di whole eart.”