Numbers 12
12:1 Den Miriam and Aaron kon tok against Moses, bikos e go marry one woman from Ethiopia.
12:2 Dem kon sey, “Na only thru Moses God dey tok to us? E neva still tok thru us too?” But God hear dem.
12:3 (Naw, na Moses honbol pass anybody wey dey di eart.)
12:4 At wons, God tell Moses, Aaron and Miriam sey: “Make una three kom meet mi for di Tabanako.” So dem kon go.
12:5 God kom down inside kloud, stand for di tent gate; den E koll Aaron and Miriam and di two of dem waka go front.
12:6 God tell dem, “Make una listin to mi: “If anybody bi profet among una, mi God go show mysef to am thru vishon kon tok with am for dream.
12:7 My savant Moses nor bi like dat; e dey faithful for my house.
12:8 So I go tok with am face-to-face and nor bi with word wey e nor go undastand and e go si as God bi. So wetin make una nor dey fear to tok against my savant Moses?”
12:9 God kon dey vex with dem so E komot der.
12:10 Wen di kloud komot di tent, leprosy kon full Miriam body like snow. Den Aaron look Miriam, kon si sey leprosy full en body!
12:11 So Aaron tell Moses, “My oga, abeg, nor let us sofa dis ponishment bikos of awa foolish sin.
12:12 Nor let us mi bi like pikin wey don die, wey e flesh don rotin before dem born am.”
12:13 Den Moses kry to God kon sey, “My God, abeg make Yu listin to am.”
12:14 God tell Moses, “If to sey na en papa just spit for en face, dem nor go disgrace am for seven days? So make e komot form di kamp for seven days and afta, e fit kom back.”
12:15 So dem porshu Miriam komot di kamp for seven days and di pipol nor travel until dem bring am kom back.
12:16 Den di pipol komot from Hazerot kon go kamp for Paran Wildaness.