Numbers 34
34:1 Den God tell Moses:
34:2 “Make yu tell Israel pipol sey: ‘Wen una enter Kanaan land and evriwhere wey I promise to go give una;
34:3 den di borda for sout go start from Zin Wildaness go rish di borda for Edom. Una sout borda go face east go rish di Salt Sea.
34:4 Den e go turn from sout go Akrabbim kon kontinue go Zin till e rish Kadesh Barnea. E go-go nort-west to Hazar Addar and Azmon,
34:5 where e go for turn face di valley wey dey Egypt borda and Mediterranean Sea.
34:6 “ ‘Di borda for west go bi di Mediterranean Sea.
34:7 “ ‘Dis go bi una borda for nort: Una go draw line from Mediterranean Sea go Mount Hor
34:8 and from der, una go draw anoda line go Lebo-Hamat. E go kontinue from der go Zedad.
34:9 Di borda go kontinue rish Zifron kon end for Hazar-Enan. Dis go bi una nort borda.
34:10 “ ‘For di borda for east: Una go draw line from Hazar-Enan go Shefam.
34:11 Di borda go from Shefam go Riblah for di east side for Ain and for Chinneret Sea.
34:12 Den e go-go Jordan River go rish di Salt Sea.’ Dis go bi di four borda for una land.”
34:13 So Moses tell Israel pipol, “Dis na di land wey una go get thru dice wey dem trow. God don give di land to di nine and half tribes.
34:14 Bikos Reuben, Gad and half for Manasseh tribe wey kom from east, don get dia propaty
34:15 for di east side for Jordan River near Jeriko.”
34:16 God tell Moses,
34:17 “Eleazar di priest and Joshua wey Nun born go divide di land for di pipol.
34:18 So make yu take one leader from each tribe, so dat dem go help divide am too.
34:19 Di men wey Moses pick from each tribe, na dia names bi dis: from Judah tribe, e pick Kaleb wey Jefunneh born;
34:20 from Simeon tribe, e pick Shemuel wey Ammihud born;
34:21 from Benjamin tribe, e pick Elidad wey Kislon born;
34:22 from Dan tribe, e pick Bukki wey Jogli born;
34:23 from Josef tribe, e pick Hanniel wey Efod born and na leader for Manasseh tribe;
34:24 from Efraim tribe, e pick Kemuel wey Shiftan born;
34:25 from Zebulun tribe, e pick Elizafan wey Parnak born;
34:26 from Issakar tribe, e pick Paltiel wey Azzan born;
34:27 from Asher tribe, e pick Ahihud wey Shelomi born;
34:28 from Naftali tribe, e pick Pedahel wey Ammihud born.”
34:29 Dis na di ones wey God kommand to divide di propaty among Israel pipol wey dey Kanaan land.