Library · pcm

Matthew 22

22:1 Jesus kon tok to dem again for parabol sey: 22:2 “God Kingdom bi like wen one king do marriage for en son. 22:3 E send en savant go koll di pipol wey dem invite kom di party, but dem nor gri kom. 22:4 “Den e send oda savants sey, ‘Make una go tell di pipol wey wi invite sey, “Si! Di party go soon start. I don kill big melu and oda animals and evritin don ready, so make una kom for di marriage.” ’ 22:5 “But di pipol nor gri listin to wetin di savants tok, instead one go en farm and di oda kon go do en business. 22:6 Di oda one seize di savants, beat dem anyhow and kill some. 22:7 Di king vex well-well kon send en sojas make dem go kill di pipol wey kill en savants and make dem burn evritin for dia town. 22:8 “Den e kon tell en savants. ‘Di marriage don start,’ di pipol wey I invite before, nor bi di pipol wey suppose kom. 22:9 So make una go di strits and invite evribody wey una si kom di party. 22:10 So di savants go di strits kon gada all di pipol wey dem si, both bad and good, kom di marriage and di hall kon full. 22:11 “Wen di king si di pipol wey kom di party, e kon si one man wey nor wear marriage klot. 22:12 So di king ask am, ‘My friend, how yu take enter here wen yu nor wear marriage klot?’ But di man nor fit ansa am. 22:13 “Den di king tell en savants, ‘Make una tie en hand and leg trow am outside for darkness, where e go kry and grind en tit.’ 22:14 “Na only few pipol God choose from di many wey e koll.” 22:15 Den di Farisee pipol komot go plan how dem go take katch Jesus with wetin e go tok. 22:16 So dem kon send dia disciples, with some pipol wey dey support Herod, go meet Jesus sey, “Tisha, wi know sey yu dey tok trut well-well and yu dey tish wetin God wont. Yu nor dey favor anybody, bikos yu nor dey play wayo. 22:17 Wetin yu tink? E good make wi pay tax give Caesar?” 22:18 But Jesus know dia wiked plan, so e kon tell dem, “Una wey dey pritend! Why una one set trap for mi? 22:19 Make una show mi di money wey una dey take pay tax.” So dem bring di money kom. 22:20 Jesus ask dem, “Wish pesin face and name dem stamp put for di money?” 22:21 Dem ansa, “Na Caesar own.” Jesus kon tell dem, “Den, make una give Caesar wetin bi Caesar own and give God, wetin bi God own.” 22:22 So wen dem hear wetin e tok, dem kon waka leave am. 22:23 For di same day, di Sadusi pipol (wey bilive sey resureshon nor dey), kom meet and ask Jesus, 22:24 “Tisha, Moses tok sey, ‘If man wey nor get pikin die, en broda must marry en wife, so dat e go fit born pikin for en broda wey don die.’ 22:25 Yu si, e get seven brodas wey dey stay here with us. Di first one marry, leta e kon die, since e nor get pikin, en broda kon marry en wife. 22:26 Di same tin happen to di sekond broda and di third one, go rish di nomba seven. 22:27 At last, di woman kon die too. 22:28 Wen pipol wey don die go kom back to life, wish pesin wife di woman go bi out of di seven brodas wey marry am?” 22:29 Jesus ansa dem, “Una dey make mistake, bikos una nor know God word and en pawa. 22:30 For resureshon day, pipol nor dey marry or give woman out for marriage, bikos dem go bi like angel for heaven. 22:31 Koncerning weda pesin wey don die go kom back to life, una neva read wetin God tell una? 22:32 God sey, ‘I bi Abraham, Isaak and Jakob God. I nor bi God for pipol wey don die, but I bi God for pipol wey dey alive!’ ” 22:33 Wen di pipol hear as Jesus dey tok, dem sopraiz for wetin e dey tish. 22:34 Wen di Farisee pipol hear sey Jesus don make di Sadusi pipol kwayet, dem kon gada. 22:35 One of dem wey bi law tish kon ask Jesus one kweshon to take try am. 22:36 “Tisha, wish kommandment big pass?” 22:37 Jesus ansa, “Make pesin love God with all en heart, with all en soul and with all en mind. 22:38 Na dis bi di first kommandment and naim big pass. 22:39 Di sekond one bi like di first one: ‘Make pesin love en neighbour as e love ensef.’ 22:40 Na dis two kommandments, Moses Law and wetin di profets tish, dey follow.” 22:41 As di Farisee pipol gada, Jesus kon ask dem one kweshon. 22:42 “Wetin una tink about Christ, wey bi di Mezaya? Wish pesin pikin e bi?” Dem kon ansa, “Na David Pikin.” 22:43 Jesus ask dem again, “Den, how kom David koll am, ‘Oga God’, thru God Spirit, wen e sey, 22:44 “Di OGA tell my Oga God sey, ‘Sidan for my rite hand, until I go put all yor enemies under yor leg.’ 22:45 If David koll am, ‘Oga God,’ den, how e kom take bi David pikin?” 22:46 So nobody fit ansa Jesus and from dat day go, nobody try to ask am kweshon again.