Library · pcm

Matthew 28

28:1 Wen day break for Sabat Day, wey bi di first day for di week, Mary Magdalin and di oda Mary kon go look di grave. 28:2 At wons, strong eartkweke happen, bikos God angel kom down from heaven, roll di stone komot kon sidan on-top am. 28:3 En face bi like tonda lite and en klot white like snow. 28:4 Di guards kon dey shake and dem bi like pipol wey won die, bikos fear katch dem well-well. 28:5 But di angel tell di wimen, “Make una nor fear, I know sey una dey look for Jesus Christ, wey dem nail for cross. 28:6 E nor dey here, bikos God don wake am up, just as God promise. Make una kom si di place where e liedan put before. 28:7 Den make una kwik-kwik go tell en disciples sey, ‘God don raiz am from deat and e dey go wait for una for Galilee. Una go si am for der.’ Make una remember sey I tell una so!” 28:8 So dem run komot from di grave with fear and dem kon dey happy as dem dey go tell en disciples. 28:9 But Jesus Christ meet dem for road kon tell dem, “I greet una o-o!” Dem dress near am, hold en leg kon woship am. 28:10 Den Jesus Christ tell dem, “Make una nor fear, but tell my brodas make dem go Galilee and dem go si mi for der.” 28:11 As dem dey go, some for di guards go inside di town go tell di priest oga dem evritin wey happen. 28:12 Afta dem don gada and plan with di eldas, dem kon give di sojas plenty money, 28:13 kon tell dem sey, “Make una tok sey, ‘Jesus Christ disciples kom tif en body for nite wen wi dey sleep.’ 28:14 If di govnor hear about dis matter, wi know wetin to tell am and una nor go enter trobol.” 28:15 So dem take di money kon do as di eldas tell dem. Pipol still dey tok dis story for evriwhere wey Jew pipol dey, kom rish today. 28:16 So di eleven disciples kon go Galilee for di mountin wey Jesus Christ tell dem. 28:17 Wen dem si am, dem woship am, but some among dem kon dey doubt. 28:18 Den Jesus Christ waka near kon tell dem, “God don give mi all di pawa wey dey heaven and eart. 28:19 So make una go make pipol my disciples for di whole world, dey baptize dem with di Papa, di Pikin and di Holy Spirit name, 28:20 dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”