Matthew 3
3:1 For dat time, John di Baptist dey prish inside wildaness for Judea sey,
3:2 “Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don near.”
3:3 Na dis John Profet Isaya tok about sey, “One pesin dey shaut inside wildaness sey, ‘Make una make God road strait.’ ”
3:4 John wear klot wey dem use kamel hair make, e use leda belt tie waist and na lokust and honey for bush, e dey chop.
3:5 Pipol from Jerusalem, Judea and all di town wey dey near Jordan River dey run go meet am
3:6 and e kon baptize dem inside Jordan River, afta dem konfess dia sins.
3:7 But wen e si many Farisee and Sadusi pipol dey kom make e baptize dem, e kon tell dem, “Una, snake shidren! Who warn una about God judgement wey dey kom?
3:8 Naw, make una do wetin go show sey una don turn from sin kom meet God,
3:9 make una nor tink sey una don free bikos una sey, ‘Abraham na awa papa.’ Make I tell una, God fit turn all dis stone to Abraham shidren!
3:10 Naw sef, dem don put di axe for di tree bottom and any tree wey nor bear betta fruit, dem go kut am trow inside fire.
3:11 “I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire.
3:12 Di fan wey e go take blow kanda komot from korn, dey en hand and e go gada and keep en korn inside store kon burn di dirty for faya wey nor dey kwensh.”
3:13 Jesus kom from Galilee make John for baptize am for Jordan River.
3:14 But John won kon stop am sey, “Na yu suppose baptize mi, instead yu kom meet mi make I baptize yu?”
3:15 Jesus ansa, “Make e bi so naw, e betta make wi do evritin wey God wont.” So, John kon baptize am.
3:16 As Jesus dey kom out from di wota afta John don baptize am, heaven open and John kon si God Spirit wey bi like dove, stay on-top Jesus head.
3:17 Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”