Mark 16
16:1 Wen Sabat Day don pass, Mary Magdalin, Mary wey bi James and Salome mama kon buy some tins wey dey send well-well, make dem go rub am for Jesus body, make e nor for smell.
16:2 For early morning on Sunday, as sun just dey kom out, dem kon go di place wey dem beri Jesus put.
16:3 Dem kon dey ask each oda as dem dey go sey, “Who go help us roll di stone komot from di grave mout?”
16:4 But wen dem look, dem si sey, dem don already roll di stone komot.
16:5 As dem enter, dem si one man wey wear white klot sidan for di rite side and fear kon katch dem.
16:6 But e tell dem, “Make una nor fear. Una dey find Jesus wey kom from Nazaret, wey dem kill. God don raiz am from deat! E nor dey here again. Make una look di place wey dem put am before.
16:7 Make una go tell en disciples and Pita sey, Jesus don go Galilee go wait for dem. Una go si am for der, as e tell una before.”
16:8 Di wimen kom out kon run from di grave side, bikos dem sopraiz and fear dey katch dem. Dem nor fit tell anybody anytin, bikos dem still dey fear.
16:9 [For early morning on Sunday, afta Jesus don wake-up, e first appear to Mary Magdalin wey e drive seven demon komot for en body.
16:10 For where di pipol wey dey follow Jesus dey mourn and kry dey, Mary Magdalin kon go tell dem wetin happen.
16:11 Wen dem hear sey Jesus don wake-up from deat and Mary Magdalin don si-am, dem nor bilive.
16:12 Afta, Jesus still appear to two pipol as dem dey waka go town.
16:13 Dem go back go tell di rest pipol, but di pipol nor still bilive dem.
16:14 Den Jesus appear to di eleven disciples wen dem dey chop. E shaut give dem since dem nor bilive, bikos of dia strong heart.
16:15 Jesus kommand dem sey, “Make una enter evriwhere for di world go prish di gospel give evribody.
16:16 Anybody wey bilive and dem baptize am, God go save am, but anybody wey nor bilive, God go kondemn am.
16:17 Dis signs go follow pipol wey bilive: With my name, dem go drive demon komot from pipol body; dem go speak new language wey dem nor learn;
16:18 dem go fit whole snake and if dem drink poizin, e nor go do dem anytin; dem go put dia hand for pipol wey nor well body and di pipol go well.”
16:19 Afta Jesus don tok to dem finish, God kon karry am go heaven and e sidan for God rite side.
16:20 Den, di disciples go evriwhere for di aria dey prish di gospel and Jesus dey do many mirakles thru dem, so dat pipol go know sey, wetin dem dey prish, na true.]