Mark 3
3:1 Wen Jesus enter di sinagog again, one man wey en hand die, dey der.
3:2 Di Farisee pipol kon dey look Jesus with korna eye weda e go heal di man for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am.
3:3 So Jesus tell di man, “Make yu stand for centre make evribody si yu.”
3:4 Jesus kon ask, “E good make wi do good or bad tin for Sabat Day? Make wi save or distroy pesin?” But dem nor ansa.
3:5 So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again.
3:6 Den di Farisee and Herod pipol kon kwik-kwik go outside go plan how dem go take kill Jesus.
3:7 Den Jesus komot with en disciples go di wotaside and plenty pipol from Galilee follow am. Pipol from Judea,
3:8 Jerusalem, Idumea, some from across Jordan River and around Tyre and Sidon kom meet am wen dem hear about di tins wey e dey do.
3:9 Bikos of di pipol, Jesus kon tell en disciples make dem prepare one small boat for am, so dat pipol nor go push am anyhow.
3:10 Jesus heal many pipol, so all di pipol wey nor well kon dey push each oda, so dat dem go fit tosh am.
3:11 And anytime evil spirit wey dey inside some pipol body si Jesus, dem go fall for en front dey shaut, “Yu bi God Pikin.”
3:12 But Jesus warn dem well-well make dem nor let pipol know who e bi.
3:13 Jesus klimb go on-top mountin kon koll di pipol wey e wont, make dem kom meet am for der.
3:14 E choose twelf pipol (wey e koll apostles), so dat dem go dey with am and e go fit send dem go prish.
3:15 E kon give dem pawa to drive demons komot.
3:16 Na di twelf wey e choose bi dis: Simon wey e koll Pita,
3:17 James and en broda John, wey bi Zebedee shidren wey Jesus dey koll “Boanerges (wey mean ‘Tonda shidren’).”
3:18 Plus Andru, Filip, Bartolomew, Matiu, Tomas, James wey bi Afaeus pikin, Taddaeus, Simon wey dem dey koll Zealot (pesin wey dey fight for en kountry),
3:19 and Judas Iskariot, wey sell Jesus give en enemies.
3:20 Jesus go house and plenty pipol kon gada am sotey en and en disciples nor fit chop.
3:21 Wen Jesus family hear wetin dey happen, dem kon go hold am, bikos pipol dey sey, “E don dey kraze.”
3:22 Di law tishas wey kom from Jerusalem sey, “Belzibub dey inside am” and “Na demon pawa e take dey drive demons komot from pipol body.”
3:23 So Jesus kon tok to di pipol for parabol sey: “How Satan go fit take drive Satan komot?
3:24 Any kingdom where pipol dey fight each oda, nor go fit stand.
3:25 And any family wey dey fight demsef, go skata.
3:26 So, if Satan kingdom divide against ensef, e nor go fit stand and en end don rish.
3:27 Nobody go fit enter strong man house tif en propaty, unless e first tie di strong man, before e go fit tif en tins.
3:28 I tell una true word, God go forgive pipol di sins wey dem kommit and all di bad word wey dem tok.
3:29 But anybody wey tok bad word against di Holy Spirit, God nor go ever forgi-am, bikos e don kommit sin wey go last forever.”
3:30 Jesus tok so, bikos some pipol sey, “Evil spirit dey inside am.”
3:31 Jesus mama and en brodas kom meet am. Dem stand for outside kon send pesin go koll am.
3:32 Di pipol wey sidan near Jesus kon tell am, “Yor mama and yor brodas dey outside, dem won si yu.”
3:33 But Jesus ansa dem, “Who bi my mama and my brodas?”
3:34 Den e look di pipol wey sidan round am kon tell dem, “Na my mama and my brodas bi dis pipol wey sidan here!
3:35 Bikos anybody wey do wetin God wont, na-im bi my broda, sista and mama.”