Library · pcm

Mark 9

9:1 Jesus kon tell dem, “I tell una true word, some pipol dey here wey nor go die until dem don si God Kingdom and en pawa.” 9:2 Afta six days, Jesus, Pita, James and John kon go one high mountin. E kon shange for dia front, 9:3 en klot kon dey shine well-well and e white pass how any dri-cleaner go fit wosh am. 9:4 Den Elijah and Moses kon appear for dia front dey tok with Jesus. 9:5 So, Pita tell Jesus, “Tisha, e good make wi stay here. Make wi build three tent, one for yu, one for Moses and one for Elijah.” 9:6 (Dem dey fear and dem nor know wetin to tok.) 9:7 Den, kloud kover dem and one vois kon tok from di kloud sey, “Dis na My only pikin wey I love. Make una listin to am!” 9:8 Wen dem look round, dem nor si anybody escept Jesus. 9:9 As dem dey kom down from di mountin, Jesus kon tell dem make dem nor tell anybody wetin dem si, until Man Pikin go don wake-up from deat. 9:10 Den dem kon dey tok with each oda about wetin dis “Wake-up from deat” mean. 9:11 Dem ask Jesus, “Wetin make di law tishas dey sey Elijah go first kom?” 9:12 Jesus ansa dem, “True-true, Elijah go first kom, make e for prepare evritin. Naim make dem rite for God word sey, ‘Man Pikin must sofa many tins and dem must hate am?’ 9:13 But I dey tell una naw sey, Elijah don kom true-true and dem don do am wetin dem like, just as God tok for en word.” 9:14 Wen Jesus, Pita, James and John kom meet di oda disciples, dem si many pipol and di law tishas gada, dey argue with dem. 9:15 Wen di pipol si Jesus, dem sopraiz kon run kwik-kwik go greet am. 9:16 Jesus ask dem, “Wetin una dey argue about?” 9:17 One pesin among di pipol kon ansa, “Tisha, I bring my pikin wey get demon wey dey make am nor fit tok, kom meet yu. 9:18 Anytime di spirit seize am, e go trow am down and e go dey bring foam from en mout, dey grind en tit and en body go kon strait. I tell yor disciples make dem drive di demon komot, but dem nor fit.” 9:19 Jesus kon ask en disciples, “Una wey nor bilive! How long I go stay with una? How long I go dey bear with una? Make una bring di boy kom meet mi.” 9:20 So, dem take di boy go meet am. Wen di spirit si Jesus, e kwik-kwik trow di boy for groun kon make am dey shake. Di boy fall for groun, dey roll and foam dey komot from en mout. 9:21 Jesus ask di boy papa, “Since wen dis tin don dey do am?” Di papa ansa, “Na since e bi small pikin. 9:22 Di spirit dey always trow am inside fire or wota make e for die. But if yu go fit do anytin, make yu sorry for am and help us.” 9:23 Den Jesus ask am, “Yu mean, ‘If I fit?’ Evritin dey possibol for di pesin wey bilive.” 9:24 Kwik-kwik di boy papa kon shaut, “I bilive o-o! Help mi make I bilive more-more!” 9:25 Wen Jesus si sey pipol dey gada, e kon tell di evil spirit, “Yu deaf and dumb spirit, I kommand make yu kom out from di boy and nor enter en body again.” 9:26 Di demon shaut, shake di boy well-well kon komot from en body. Di boy sleep for groun sotey many pipol kon dey sey, “E don die!” 9:27 But Jesus whole di boy hand small-small, karry am up and di boy kon stand up. 9:28 Wen e enter di house, en disciples kon ask am, “Why wi nor fit drive di demon komot?” 9:29 Jesus ansa dem, “Na only with prayer and fasting dis kind one dey take komot.” 9:30 Jesus and en disciples kon komot from der pass Galilee. But Jesus nor wont make anybody know, 9:31 bikos e dey tish and tell en disciples sey, “Dem go sell Man Pikin give human being. Dem go kill-am and afta three days, e go wake-up again.” 9:32 But di disciples nor undastand wetin Jesus tok and fear nor let dem ask am wetin e mean. 9:33 Dem kon rish Kapanaum. So, wen Jesus don enter house, e kon ask en disciples, “Wetin una dey tok for road?” 9:34 But dem nor ansa, bikos wen dem dey kom for road, na who big pass among dem, dem dey argue about. 9:35 Afta Jesus sidan, e koll en twelf disciples kon tell dem, “If anybody among una won bi first, e go bi di last and e go bi evribody savant.” 9:36 E kon koll one small pikin stand for dia front. Den e whole di pikin hand, kon sey, 9:37 “Anybody wey welkom one of dis small pikin bikos of mi, na mi e welkom and anybody wey welkom mi, nor bi mi alone e welkom, but na my Papa wey send mi.” 9:38 John kon tell am, “Tisha, wi si one man wey use yor name dey drive demon komot from inside pipol body and wi kon try to stop am, bikos e nor dey follow us waka.” 9:39 But Jesus tell dem, “Make una nor stop am, bikos nobody wey use my name do mirakle go fit tok bad tin about mi. 9:40 Bikos anybody wey nor dey against us, dey for awa side. 9:41 I tell una true word, anybody wey give yu cup of wota bikos yu dey follow mi, nor go ever luz en reward. 9:42 “If anybody make one among dis small pikin wey bilive mi kommit sin, e go betta make dem tie big stone for en neck kon trow am inside river. 9:43 If yor hand go make yu sin, make yu kut am komot! E betta make yu enter inside God Kingdom with one hand, dan to get two hand kon enter hell-fire wey nor go ever kwensh, 9:44 di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh. 9:45 If yor leg go make yu sin, make yu kut am komot. E betta make yu enter God Kingdom with one leg, dan to get two leg kon enter hell-fire wey nor dey ever kwensh, 9:46 di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh. 9:47 If yor eye go make yu sin, make yu pul am komot! E betta make yu enter God Kingdom with one eye, dan to get two eye kon enter hell-fire wey nor dey ever kwensh, 9:48 “di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh. 9:49 God go try evribody with fire. 9:50 “Salt good, but if e nor get taste again, how pesin go fit take make am sweet? Make una get salt inside una and make una dey live for peace with each oda.”