Luke 15
15:1 Anytime Jesus dey prish, tax kollectors and sinnas dey kom listin to am.
15:2 But di Farisee pipol and di law tishas dey komplain sey, “Dis man dey follow sinnas chop.”
15:3 So, Jesus kon tell dem dis parabol:
15:4 “If yu get hundred sheep and one lost, yu nor go leave di ninty-nine wey remain go find dat one till yu si am?
15:5 Den wen yu si am, yu go karry am for shoulder, dey happy.
15:6 Wen yu rish house, yu go koll yor friends and neighbours sey, ‘Make una kom follow mi happy, bikos I don si my sheep wey lost before.’
15:7 I tell una true word, na so happiness dey for heaven wen one sina turn from sin kom meet God, pass ninty-nine good pipol wey don already dey with God.
15:8 “Or, if one woman get ten koins and one lost, wetin e go do? E nor go lite lamp, swip di whole house until e si am?
15:9 Wen e don si am, e go koll en friends and neighbours gada kon sey, ‘Make una kom follow mi happy, bikos I don si my money wey lost before.’
15:10 I tell una true word, na so God angels dey happy, wen one sina turn from sin kom meet God.”
15:11 Den Jesus sey, “One man dey wey get two sons.
15:12 Di yonga one kon tell en papa, ‘Give mi my own share for awa propaty.’ So en papa kon gi-am.
15:13 “Afta sometaim, di yong boy karry evritin wey e get travel go one far kountry kon waste all en money for yeye life.
15:14 Wen e don finish all wetin e get, e nor si anytin to chop, bikos honga dey for dat kountry, so e kon dey sofa.
15:15 E kon dey work for one man for der, di man dey send am go en farm go give pig food.
15:16 Di honga kon make am dey won chop di food wey di pig dem dey chop, bikos nobody gi-am food.
15:17 “But wen en eye klear, e kon sey, ‘All my papa workers get food wey dem nor fit chop finish, but hongry don nearly kill mi for here!
15:18 I go get up go meet my papa tell am, “Papa I don sin against heaven and against yu.
15:19 I nor rish make dem koll mi yor pikin again. Make yu take mi as yor worker.” ’
15:20 So e get up kon go meet en papa. “But wen en papa si am dey kom from far, e sorry for am, run go meet am, hold am near body kon kiss am.
15:21 “Den di pikin tell am, ‘Papa, I don sin against heaven and yu. I nor rish make dem koll mi yor pikin again. Make yu take mi as yor worker.’
15:22 “But di papa koll en savants kon tell dem, ‘Make una bring di best klot, ring and shoe and make una wear dem for my pikin.
15:23 Den, make una go take di melu wey fat pass, kill-am make wi do party,
15:24 bikos dis my pikin die before, but naw, e don kom back to life, e lost before, but naw, I don si am!’ So di party kon start.
15:25 “By dat time, di senior son dey kom from farm where e go work. Wen e don near house, e kon dey hear music and si pipol dey dance.
15:26 So e koll one savant kon ask am, ‘Wetin dey happen?’
15:27 Di savant ansa, ‘Yor broda don kom back and yor papa don kill di melu wey fat pass, bikos e kom back well and nor-tin bad happen to am.’
15:28 “Di senior broda kon dey vex and e nor gri enter house, so en papa kon beg am make e enter.
15:29 So, e tell en papa, ‘Si, all dis many years I dey work like slave for yu and e nor get anytime wey I disobey yu, but yu neva give mi even one small goat make I do party with my friends.
15:30 But wen dis yor pikin kom back afta e don waste all yor money with ashawo, yu kon kill di melu wey fat pass for am!’
15:31 “Den di papa tell am, ‘My pikin, yu always dey here with mi and evritin wey I get na yor own.
15:32 But e good make I do party, bikos yor broda die before, but naw, e don kom back to life, e lost before, but naw, wi don si am.’ ”