Library · pcm

Luke 2

2:1 Dat time, Caesar Augustus kon give orda make evribody wey dey Rome go register dia name make dem for pay tax. 2:2 Dis na di first time wey pipol go register, since di time wen Kwirinus bi govnor for Siria. 2:3 Evribody kon go en home-town go register. 2:4 So Josef wey dey stay for Nazaret for Galilee kon travel go Betlehem, David Town for Judea, bikos na David family e from kom. 2:5 Josef and Mary wey e won marry wey get belle, go register togeda. 2:6 As dem dey for Betlehem, time kon rish for marry to born. 2:7 So e born en first son, wrap am kon put am for where dem dey keep animal, bikos know oda place dey for dem to stay. 2:8 Some shepads dey for dat aria, dey kare for dia sheep for nite. 2:9 God angel appear to dem and God glory kon dey shine for evriwhere, den fear katch dem. 2:10 Di angel tell dem, “Make una nor fear! Make una listin well, bikos I kom tell una news wey go make pipol happy. 2:11 Today, dem born una Savior for dis town wey David from kom, en name na Christ, wey bi di Oga God. 2:12 Na dis go bi sign wey una go take know am: Una go si pikin wey dem use klot wrap inside where dem dey keep animal.” 2:13 At wons, many angels appear for heaven kon stand with di first angel dey praiz God sey, 2:14 “Na only God get Glory for heaven and eart, make peace and favor dey with evribody.” 2:15 Wen di angels go back to heaven, di shepads kon tell each oda, “Make wi go Betlehem go si wetin happen, wey God don show us so.” 2:16 Dem kon go si Mary, Josef and di pikin for inside di animal house. 2:17 Wen dem si am, dem kon tok how di angel take tell dem about di pikin. 2:18 Evribody wey hear wetin dem tok, sopraiz well-well. 2:19 But Mary keep wetin e hear for en mind kon dey tink about am. 2:20 So di shepads go back, dey praiz God, bikos of all di tins wey dem hear and si. Evritin just bi as di angel tell dem sey e go bi. 2:21 Wen di pikin rish eight days, dem sekonsaiz am kon koll am, “Jesus”, di name wey di angel tok before en mama even get belle. 2:22 Wen time rish for Mary to present ensef to God, as Moses Law tok, Josef and Mary kon karry Jesus go Jerusalem, go dedikate am give God, 2:23 (as dem rite am for God word, “Evry first-born wey bi boy, dem go gi-am to Mi”), 2:24 and dem go offa sakrifice with two dove or pijin. 2:25 One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel. 2:26 Di Holy Spirit don show am sey e nor go die before e go si di Mezaya wey God promise. 2:27 So God Spirit karry Simeon enter di temple and wen Jesus papa and mama bring am to do wetin Moses Law tok, 2:28 Simeon kon karry Jesus for en hand dey praiz God sey, 2:29 “Naw, as yor word tok, yu, God wey dey rule evritin, make yu let yor savant go rest. 2:30 Bikos my eye don si di pesin wey yu won make e save Israel pipol, 2:31 di One wey yu don prepare for evribody present: 2:32 Na-im bi di lite wey go show Gentile pipol road kon bring honor to yor pipol, Israel.” 2:33 So di pikin papa and mama sopraiz for wetin Simeon tok about am. 2:34 Den Simeon bless dem kon tell Mary, “Listin well-well: God don choose dis pikin to make some pipol for Israel fall and raiz odas up and e go bi sign wey many pipol nor go asept. 2:35 True-true, bikos of am, di sekret tins for many pipol mind go kom out and vexnashon like swod, go shuk dia heart!” 2:36 One profetes dey, wey en name bi Anna, Fanuel dota, wey kom from Asher family. E don old well-well and e marry en husband for seven years, before di man die. 2:37 E don rish eighty-four years since en husband die. E nor dey komot for di temple, e dey serve God and dey fast and pray day and nite. 2:38 For dat time, e kom meet Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok about di pikin give evribody wey dey wait for di time wen God go free Jerusalem. 2:39 So, wen Josef and Mary don do all di tins wey God law sey make dem do, dem kon go back to dia house for Nazaret for Galilee. 2:40 Di pikin kon grow, dey strong, e get sense and God favor, dey with am. 2:41 Evry year, Jesus papa and mama dey go Jerusalem for Passova Feast. 2:42 Wen Jesus bi twelf years, dem kon go as dem dey do before 2:43 and as dem dey go back to dia house, Jesus nor follow dem, but en papa and mama nor know; 2:44 bikos dem tink sey e dey among dem wey dey travel togeda. Wen dem don travel for one full day, dem kon dey find Jesus among dia rilashons and friends. 2:45 As dem nor si am, dem kon go back to Jerusalem go find am. 2:46 Afta three days, dem kon si am inside di temple, where e sidan with di tishas dey listin and dey ask dem many kweshon. 2:47 Evribody wey hear wetin Jesus dey tok kon dey sopraiz for di way e undastand and di ansa wey e dey give. 2:48 Wen en papa and mama si am, dem sopraiz well-well. Naim en mama sey, “My pikin, why yu do us like dis? Si, mi and yor papa dey find yu for evriwhere since.” 2:49 Jesus ansa dem, “Why una dey find mi? Una nor know sey I go dey my Papa house?” 2:50 But en papa and mama nor undastand wetin Jesus mean. 2:51 Den Jesus follow dem go Nazaret kon dey do wetin dem tell am. But en mama keep all dis tins for mind. 2:52 Jesus kon dey get sense more-more as e dey grow, so God and pipol like am well-well.