Library · pcm

Luke 24

24:1 For early morning for di first day for di week, di wimen karry di perfume wey dem prepare go di grave where dem beri Jesus put. 24:2 Dem kon si sey dem don roll di stone komot from di grave mout, 24:3 but wen dem enter inside, dem nor si Jesus body for der. 24:4 As dem dey konfuse bikos of dis tin, dem kon si two men wey dia klot dey shine like lite and dem stand for korna. 24:5 Fear katch di wimen and dem kon face groun. But di men tell dem, “Why una dey find pesin wey dey alive for where dead body dey? 24:6 E nor dey here again, God don wake am! Una remember wetin e tell una wen e dey Galilee sey, 24:7 ‘Dem must sell Man Pikin give wiked pipol and dem go kill-am trowey and for di third day, e go wake-up.’ ” 24:8 Den di wimen kon remember wetin Jesus tell dem, 24:9 so dem komot from di grave kon go tell di eleven apostles and di rest pipol wetin happen. 24:10 Na Mary Magdalin, Joanna, Mary wey bi James mama and di oda wimen wey dey with dem, na dem tell di apostles all dis tins. 24:11 But dia word nor mean anytin to di apostles, so dem nor bilive di wimen. 24:12 But Pita kon get up, run go di grave. E ben-down look inside and e si only di klot, den e kon go house dey wonder wetin happen. 24:13 Dat day, two men among Jesus disciples dey waka go one village wey dem dey koll Emmaus, wey nor too far from Jerusalem. 24:14 Dem dey tok to each oda about di tins wey happen. 24:15 As dem dey tok, Jesus kon bigin waka with dem, 24:16 (but Jesus nor let dem know who e bi.) 24:17 Den Jesus kon ask dem, “Na wetin make una dey tok like dis for road?” Dem kon stand for one place, dey sopraiz for am. 24:18 Den one among dem, wey en name bi Kleopas, kon tell am, “Na only yu bi strenja for Jerusalem wey nor know di tins wey dey happen since?” 24:19 Jesus ask dem, “Wish tins?” Dem ansa, “Di tins about Jesus wey kom from Nazaret, one man wey wetin e dey tok and do show sey en na God profet 24:20 and how awa priest oga dem and di pipol wey dey rule us kill-am trowey. 24:21 But wi bin hope sey naim go free Israel and dis tins don happen for three days naw. 24:22 Some wimen wey dey with us kon even sopraiz us. Dem go where dem beri am put dis morning 24:23 and dem nor si en body for der. Dem kom back dey tok sey dem si angels wey tell dem sey Jesus dey alive. 24:24 Den some pipol wey dey with us kon go di grave and dem si evritin as di wimen tok, but dem nor si Jesus.” 24:25 So Jesus tell dem, “Una nor get sense and una nor dey kwik bilive wetin all di profets tok. 24:26 Dem nor tok sey di Mezaya go must sofa all dis tins and den e go enter en glory?” 24:27 Den e kon use wetin Moses and all di profets rite take tell dem wetin God tok about am for en word. 24:28 As dem near di village wey dem dey go, Jesus do like sey e won waka go front, 24:29 but dem tell am, “Make yu stay with us, bikos evening don nearly rish and day go soon dark.” So Jesus enter di village kon follow dem stay. 24:30 E sidan for where dem dey chop; e take bread, bless am kon divide am give dem. 24:31 At wons dia eye open and dem kon know am. Den e vanish from dia front. 24:32 Dem kon tell each oda, “No wonder e bi like sey fire dey burn inside awa heart wen e dey tok with us for road about God!” 24:33 So dem get up at wons go back to Jerusalem. Dem si di eleven apostles and di oda pipol wey dey with dem 24:34 kon tell dem, “Jesus don really wake-up and e don appear to Simon!” 24:35 Den dem tok wetin happen for road and how dem take know Jesus wen e divide di bread. 24:36 As dem still dey tok, Jesus kon stand with dem, tell dem, “Make peace dey with una.” 24:37 But dem shok kon bigin fear, bikos dem tink sey na spirit dem dey si. 24:38 Den Jesus kon sey, “Why una dey fear and nor bilive? 24:39 Make una look my hand and leg and make una tosh mi: spirit nor get flesh and bone as una si sey I get.” 24:40 Wen Jesus don tok dis one, e kon show dem en hand and leg. 24:41 And as dem neva still bilive (bikos of dia happiness) and still dey sopraiz, Jesus ask dem, “Una get anytin to chop for here?” 24:42 So dem kon gi-am fish wey dem don kook, 24:43 e kon take am chop for dia front. 24:44 Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.” 24:45 Den e open dia mind so dat dem go fit undastand God word 24:46 kon tell dem, “Na wetin dem rite bi dis, ‘Di Mezaya go sofa and e go wake-up from deat for di third day 24:47 and dem go use en name prish give pipol make dem for turn from dia sin kom meet God and di prishin go start from Jerusalem.’ 24:48 Una bi witness for dis tins. 24:49 I dey send wetin my Papa promise kom meet una. So make una stay for dis town until pawa go kom from heaven kon kover una.” 24:50 Den Jesus take dem go Betany kon lift en hand and bless dem. 24:51 As e dey bless dem, God kon karry am go heaven. 24:52 So, dem woship am kon go back to Jerusalem dey happy well-well 24:53 and dem dey go di temple evritime, dey praiz God.