Library · pcm

John 13

13:1 Before dem do di Passova Feast, Jesus know sey en time don rish wen e go komot for dis world go meet en Papa. Bikos e love di pipol wey dey di world, e kon show dem how en love for dem strong rish. 13:2 Before dem start to chop evening food, devil don already enter Judas Iskariot mind, wey bi Simon pikin sey, make e sell Jesus give en enemy. 13:3 Bikos Jesus know sey en Papa don gi-am pawa to kontrol evritin and as e bi sey e kom from God and e dey go back go meet am, 13:4 e kon stand up for where dem dey chop, remove en big koat kon tie towel for en waist. 13:5 E pour wota for basin, bigin dey wosh en disciples leg and dey dry dem with di towel wey dey en waist. 13:6 Wen e rish Simon Pita turn, Pita kon tell am, “Oga God, yu won wosh my leg?” 13:7 Jesus ansa, “Yu nor go fit undastand wetin I dey do naw, but yu go undastand am leta.” 13:8 Pita tell am, “I nor go gri make yu wosh my leg!” Den Jesus ansa, “If I nor wosh yor leg, mi and yu nor go get anytin togeda again.” 13:9 So Simon Pita tell am, “Oga God, make yu nor wosh only my leg, but make yu wosh my hand and head too!” 13:10 Jesus ansa, “Di pesin wey don baf, only nid to wosh en leg, bikos e don dey klean. Una dey klean, but nor bi all of una.” 13:11 (Bikos Jesus know di pesin wey go sell am, naim make am sey, “Nor bi all of una dey klean.”) 13:12 So wen Jesus don wosh dia leg finish, e kon wear en big koat back. Den e go sidan for di tabol kon ask dem, “Una undastand wetin I do for una so? 13:13 Una dey koll mi ‘Tisha’ and ‘Oga God’, una korrect, bikos na so I bi. 13:14 So, if mi wey bi una oga and tisha, wosh una leg, e good make una wosh each oda leg too. 13:15 I don give una ezample wey una go follow. So make una do for each oda as I don do for una. 13:16 Make I tell una true word, savant nor dey big pass en oga, just as di pesin wey bi messenja nor dey big pass di oga wey send am. 13:17 Since una know wetin I dey tok, God go bless una, if una do dem. 13:18 “Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’ 13:19 “I don tell una before e go happen, so dat wen e happen, una go bilive sey na mi bi Christ. 13:20 I dey tell una true word, anybody wey receive di pesin wey I send, don receive mi and anybody wey receive mi, don receive God wey send mi kom.” 13:21 Wen e don tok dis tin finish, en heart kon heavy well-well, den e sey, “I dey tell una true word, one of una go sell mi give my enemy.” 13:22 Di disciples look each oda kon dey worry and tink for dia mind sey, “Wish pesin e dey tok about?” 13:23 John, di disciple wey Jesus love well-well, sidan for en rite hand wen dem dey chop. 13:24 So, Simon Pita kon use eye tell am sey make e ask Jesus wish pesin e dey tok about. 13:25 Den John bend en head near Jesus chest kon ask am, “Oga God, who yu dey tok about?” 13:26 Jesus ansa, “Na di pesin wey I go give dis bread afta I don shuk am inside di pot.” Den e shuk di bread inside di pot kon gi-am to Judas Iskariot, wey bi Simon pikin. 13:27 Afta Judas take di bread, devil enter en mind. Jesus kon tell am, “Di tin wey yu won do, make yu go do am kwik-kwik.” 13:28 (No one among dem wey sidan for di tabol undastand why Jesus tok to Judas like dat. 13:29 Some of dem tink sey, since na Judas dey keep di money, Jesus tell am sey make e go buy wetin dem go use for di feast or make e give poor pipol money). 13:30 Wen Judas don take di bread, e hurry komot for di place. (By dis time, day don dark.) 13:31 Wen e don komot, Jesus kon sey, “Naw, di time don rish wen God go honor en pikin and en pikin go honor am too. 13:32 Wen di pikin don honor God, God go honor am too. 13:33 “My shidren, na small time remain wey I go dey with una. Leta, una go dey find mi and as I tell di Jew oga dem before sey, ‘Where I dey go una nor go fit kom der’, na di same word I dey tell una naw. 13:34 “I dey give una new kommand: Una must love each oda, as I love una, 13:35 so dat evribody go know sey, una bi my disciples if una love each oda.” 13:36 Simon Pita kon tell am, “Oga God, where yu dey go?” Jesus ansa, “Una nor go fit follow mi go di place wey I dey go naw, but una go kom meet mi for der leta.” 13:37 Pita ask am, “Oga God, why wi nor go fit follow yu naw? I ready to die bikos of yu!” 13:38 Jesus ansa am, “Yu really ready to die for mi? Make I tell yu true word, before fawol go do ‘Kukuruku’ dis nite, yu go tok three times sey, yu nor know mi.”