Acts 10
10:1 One man wey en name bi Kornelius dey stay for Caesaria and e bi offisa for Italy soja.
10:2 E dey holy and en and en family dey woship God. E dey help di pipol well-well and dey pray to God evritime.
10:3 One day, around three oklok for aftanoon, e si vishon where God angel for koll am, “Kornelius.”
10:4 Fear katch am as e dey look di angel, so e ansa, “Oga God, Wetin yu wont?” Di angel tell am, “God don hear yor prayer and si all di good tins wey yu dey do for poor pipol.
10:5 So, send some men go Joppa make dem go koll one man wey en name bi Simon Pita.
10:6 Di man dey stay with Simon wey dey do leda work and di house dey near di sea.”
10:7 Wen di angel don go, Kornelius kon koll two of en house boys with one soja wey dey serve am
10:8 and wen e don tell dem evritin wey happen, e kon send dem go Joppa.
10:9 For aftanoon for di next day, as di men dey near di town, Pita kon go di housetop go pray,
10:10 afta sometaim, e kon dey hongry, but di food neva ready. As e dey wait, e kon si vishon.
10:11 For di vishon, e si sey heaven open and sometin wey bi like tray, wey dem whole for en for korna kon dey kom down small-small.
10:12 Difren-difren animals wey get four legs and di ones wey dey creep for groun and difren birds dey inside di tray.
10:13 Den one vois tell am, “Pita, get up, kill make yu chop.”
10:14 But Pita ansa, “Oga God, I nor go fit, bikos yu know sey since dem born mi, I neva chop anytin wey get blood or wey nor klean.”
10:15 But di vois tell am, “Wetin God don make klean, make yu nor forbid am.”
10:16 Dis tin happen three times and di tray kon go back to heaven.
10:17 As Pita still dey wonder wetin di vishon mean, di men wey Kornelius send kon rish Simon house.
10:18 Dem ask if anybody wey bi Simon Pita dey di house.
10:19 As Pita still dey tink about di vishon, di Holy Spirit kon tell am, “Look! Three men dey find yu.
10:20 Make yu get up go meet dem and make yu follow dem, bikos na Mi send dem kom.”
10:21 So Pita go down go meet di men kon sey, “Na mi bi di pesin wey una dey look for. Wetin bring una kom?”
10:22 Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”
10:23 So Pita sey make dem enter house and e welkom dem well-well. Di next day, e kon follow dem go and some brodas for Joppa, follow am go too.
10:24 Afta dem don travel for one full day, dem kon rish Caesaria. Kornelius don gada all en family and friends dey wait for dem.
10:25 So as Pita enter di kompond, Kornelius knee down for en front kon dey woship am.
10:26 But Pita hold am kon sey, “Stand up, bikos I bi ordinary human being like yu.”
10:27 As Pita still dey follow am dey tok wen e enter di house, e kon si sey many pipol gada dey wait am.
10:28 E tell dem, “Una know sey di law nor allow us, wey bi Jew pipol, to visit Gentile pipol or follow dem do anytin, but God don show mi sey make I nor sey anybody nor dey klean.
10:29 Na dis make wen una send pipol kom koll mi, I nor sey ‘No’. So make una tell mi, ‘Why una koll mi?’ ”
10:30 Kornelius ansa, “For days ago, for dis kind time for aftanoon, as I dey pray for my house, one man wey en dress dey shine kon stand for my front.
10:31 E kon sey, ‘Kornelius, God don hear yor prayer and E don remember all di good tins wey yu dey do.
10:32 So make yu send pipol go Joppa go koll Simon, wey dem dey koll Pita. E dey stay as strenja with Simon wey dey do leda work, wey e house dey near di sea.’
10:33 So, I kon send pipol go koll yu and yu do well as yu kom. Na wi bi dis for God present, wi ready to hear wetin E sey make yu tell us.”
10:34 Den Pita tell dem, “Naw, I don undastand sey God nor dey opress anybody,
10:35 but for evry tribe, di pesin wey fear am and dey do wetin good, na dat pesin, E dey like.
10:36 Una know di message wey E send to Israel pipol, wen E tok about di Good News wey dey give peace, thru Jesus Christ, di real Oga God.
10:37 Una know wetin happen from Galilee go rish Judea afta John prish sey,
10:38 Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.
10:39 All of us si di tins wey e do for Judea and Jerusalem, but dem hang am for three kon kill-am.
10:40 But God raiz am for di third day kon allow pipol si am.
10:41 Nor bi evribody si am, but na di ones wey God don choose, wey follow am chop and drink afta e don wake-up from deat.
10:42 E kon kommand us make wi prish and warn pipol sey, na en ensef bi di Pesin wey God choose make e judge pipol wey dey alive and di ones wey don die.
10:43 All di profets tok about am sey, ‘Evribody wey bilive am, thru en name, God go forgive dem.’ ”
10:44 As Pita still dey tok, di Holy Spirit kon enter inside all di pipol wey dey hear di message.
10:45 Di bilivers wey bi Jew wey follow Pita go Joppa kon sopraiz well-well sey Gentile pipol too, fit receive di Holy Spirit,
10:46 bikos dem dey hear wey dem dey use difren-difren language take dey praiz God. Den Pita sey,
10:47 “Anybody go fit sey make wi nor baptize all dis pipol wey don receive di Holy Spirit, just like us?”
10:48 So e sey make dem baptize dem for Jesus Christ name. Den di pipol sey make e stay with dem for some days.