1 Corinthians 13
13:1 If I dey tok di language wey human being and angels dey tok;
13:2 if I dey profesai and fit undastand evry sekret and knowledge or if I get faith wey fit move mountins and I nor love oda pipol, I go bi nor-tin.
13:3 If I give pipol evritin wey I get kon sey make dem burn mi alive, but I nor love odas, I nor go gain anytin.
13:4 Love dey kind and patient, e nor dey jealous or boast
13:5 or dey proud. Love nor get long-trot or dey vex. E nor dey remember di bad tins wey odas do.
13:6 E nor dey happy with wiked pipol, but e dey happy with di trut.
13:7 Love dey bear evritin and e get faith, hope and patient.
13:8 Love nor dey fail and e go dey forever. Pipol nor go profesai forever and doz wey dey tok with difren-difren language, go stop. For dat time, wi go forget evritin wey wi know.
13:9 Naw, wi nor know evritin and awa profesy nor komplete.
13:10 But one day, wetin dey pafet go kom and wetin nor dey pafet, go vanish.
13:11 Wen wi neva know Christ, wi dey tink and tok like small shidren. But naw wen wi don know am, wi nor dey do like small shidren again.
13:12 Evritin wey wi dey si naw bi like ordinary image for mirror; but for dat time, wi go si am, face-to-face. Naw wi nor know evritin, but den wi go know, just as God really know us.
13:13 And naw wi get faith, hope and love. But di one wey big pass for di three, na love.