Library · pcm

1 Corinthians 16

16:1 Wen una kollect money from God pipol, I wont make una do as I tell di pipol wey dey di church for Galatia sey make dem do. 16:2 Evry Sunday, make each pesin dey keep some money for korna from di one wey e don work, as God help am rish, so dat una nor go nid to kollect money wen I kom. 16:3 Wen I kom, I go send pipol wey una choose kon give dem leta as dem dey karry una gifts go Jerusalem. 16:4 But if una sey make I go too, den, dem go follow mi go. 16:5 And afta I don finish for Masidonia, I hope to kom si 16:6 and stay with una for sometaim. May bi I fit stay till dry sizin finish, so dat una go fit help mi for anywhere wey I won go. 16:7 If God go let mi, I nor go one branch si una for small time naw, bikos I go like kom leta, so dat I go fit spend more time with una. 16:8 But I go stay for Efesus until Pentekost go finish, 16:9 bikos plenty work dey wait for mi for der, even doh di shalenge strong well-well. 16:10 Wen Timoti kom, make una nor make am fear at-all, bikos na God work wey I dey do, naim e dey do too. 16:11 So make evribody respet am, den make una send am kom meet mi with peace, bikos I dey espect am with di oda brodas. 16:12 I don try well-well make Apollos for fit follow oda bilivers kom visit una, e nor won kom naw, but e go kom leta. 16:13 Make una shine una eye and dey strong for una faith and stand with boldness. 16:14 For evritin wey una dey do, make una dey show love. 16:15 Una know sey na Stefanas and en family first bilive God for Akaia. Dem don do evritin wey dem fit do for God pipol. My friends, I wont make una 16:16 dey obey dis leaders and doz wey dey follow una do God work. 16:17 I dey happy sey Stefanas, Fortunatus and Akaikus don kom; dem kom ripresent una 16:18 and dem don let belle sweet mi, just as dem make belle sweet una. E good make wi dey tok about pipol like dem. 16:19 Pipol for di church wey dey Asia aria dey greet una; Akwila and Priscilla with di church pipol wey dey meet for dia house, dey greet una too. 16:20 All di brodas sey make I greet una. 16:21 Na mi Paul, rite dis leta with my own hand. 16:22 Anybody wey nor love Christ, curse dey en head! 16:23 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una. 16:24 Make my love for Jesus Christ, dey with all of una too.