Library · pcm

2 Corinthians 2

2:1 So I sey I nor go kom visit una, so dat una nor go vex again. 2:2 Bikos if I make una vex, who go make mi dey happy apart from una wey dey vex for mi? 2:3 Na dis make mi rite dis tin give una, so dat wen I kom, I nor go kon dey vex for di pipol wey suppose make mi happy, bikos I know sey if I dey happy, una go dey happy too. 2:4 Na pain for my heart I take rite dis leta give una, nor bi to make una vex, but na to let una know di kind love wey I get for una. 2:5 Naw if anybody don make pesin vex, nor bi only mi e make vex, but na all of una. (I dey tok like dis bikos I nor won too vex for di pesin). 2:6 Di way wey una ponish dis pesin, don rish. 2:7 So make una forgive and help am, so dat e nor go luz hope and life nor go taya am. 2:8 So make una let am know sey una really love am. 2:9 I rite dis leta give una, so dat I go know weda una dey obey wetin I tell una. 2:10 Wen una forgive pesin for wetin e do, misef go forgi-am. Bikos wen I forgive (if I really nid to forgive), I do am for Christ present, bikos of una, 2:11 so dat Satan nor go deceive us, bikos wi know en wayo. 2:12 Wen I go prish di Good News for Troas, even doh Christ open door for mi, 2:13 my mind nor rest, bikos I nor si awa broda, Titus, for der. So I leave der kon go Masidonia. 2:14 But make wi tank God wey make us winners inside Christ. Bikos thru us, many pipol don know tins about Christ, like betta perfume wey dey smell for evriwhere. 2:15 Bikos wi bi like sweet smell wey Christ offa give God wey dey spread among doz wey dey save and doz wey don lost. 2:16 To doz wey don lost, e bi like sometin wey dey kill; but for doz wey Christ don save, e bi like smell wey dey give life. So, who go fit handle all dis tins? 2:17 Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.