Library · pcm

2 Corinthians 6

6:1 Naw, bikos wi bi fellow workers, wi dey beg una make una nor waste God grace wey una don receive. 6:2 Bikos E sey, “I hear una for di rite time and wen di day for Mi to save una rish, I help una.” Si, na di rite time bi dis; na naw bi di day for salvashon! 6:3 Wi nor dey do anytin wey go make anybody vex, so dat nobody go si any fault for awa work. 6:4 But wi dey show sey wi bi God savant for evritin wey wi dey do. Wi dey sofa well-well and face trobol for dis time; even for wiked times; 6:5 for di time wey dem dey beat us and put us for prison; for di time wey dem dey fight; for wahala time; for nite wey wi nor fit sleep and for hongry time. 6:6 Wi dey do all dis tins with awa klean life, di tins wey wi know; di patient wey wi get; di good wey wi dey do for pipol; di Holy Spirit wey wi get; betta love wey wi show pipol; 6:7 thru di word wey wi dey tish with God pawa; with wetin wi take dey defend awa raitiousness both for awa rite and left hand; 6:8 for di time wey dem honor or disgrace us; for di time wen dem tok bad about us or praiz us; di time wey dem do us like sey wi dey tok lie, but wi dey tok trut. 6:9 Dat time, e bi like sey nobody know us, but evribody know us; e bi like sey wi don die, but wi dey alive; wi still dey alive like pipol wey dem dey ponish, but dem nor fit kill us; 6:10 wi dey like sey wi dey vex, but wi dey always happy; wi bi like poor pipol, but wi dey make many pipol rish; wi bi like who nor get anytin, but wi get evritin. 6:11 So, una wey bi Korint pipol, wi don open awa heart tell una evritin. 6:12 Wi nor dey whole awa love from una, but na una dey whole una love from us. 6:13 So make wi make am ekwol. I dey tok to una like sey una bi my shidren, so make una open una heart for us too. 6:14 Make una nor make friend with pipol wey nor bilive, bikos, na wish kind friend raitiousness and bad tin won bi, or na wetin lite and darkness get togeda? 6:15 And na wish kind agriment Christ and devil get? Wetin koncern pesin wey bilive and pesin wey nor bilive? 6:16 Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.” 6:17 Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una 6:18 kon bi una Papa and una go bi my shidren.” Na so God wey get all di pawa, tok.