Library · pcm

Galatians 1

1:1 Na mi Paul, rite dis leta, (nor bi human being make mi apostle, but na Jesus Christ and God awa Papa wey raiz am from deat). 1:2 Mi and di brodas wey dey here, dey greet una wey dey Galatia. 1:3 Make God awa Papa and Oga God Jesus Christ grace and peace, dey with una. 1:4 Na Jesus die for awa sins, bikos na so God awa Papa wont am. 1:5 Make all glory bi en own forever and ever! Amen. 1:6 I sopraiz sey una kwik turn back from di Pesin wey koll una with en grace kon bigin follow oda tishing. 1:7 Nor bi sey anoda gospel really dey, but some pipol dey disturb una, bikos dem won shange wetin wi prish about Christ. 1:8 But if wi (or angels wey kom from heaven) tish una difren tins from di one wey wi prish give una before, make God distroy us with fire! 1:9 As I tok before, I dey repeat am again, if anybody dey tish difren tins from di ones wey wi prish give una before, make God trow dat pesin for hell! 1:10 Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again! 1:11 My brodas and sistas, I wont make una know sey di gospel wey I dey prish, nor bi human being give mi. 1:12 Bikos I nor get or learn am from anybody, but I get am thru di revelashon wey Christ give mi. 1:13 Una don hear about di kind life wey I dey live before as Jew pesin; how I trobol di church kon dey try to distroy am. 1:14 I grow among Jew pipol kon know di relijon pass many of my mates for my kountry and I know my grand-grand papa dem tradishons. 1:15 But God koll mi with en grace kon separate mi even before dem born mi. 1:16 E show mi en pikin, so dat I go fit prish about am give Gentile pipol. I nor go meet anybody make e advise mi 1:17 and I nor go Jerusalem go meet pipol wey bi apostle before mi, but I komot der go Arabia, den I kon go back to Damaskus. 1:18 Afta three years, I go visit Pita for Jerusalem, so dat e go tell mi wetin I go do and I stay with am for fifteen days. 1:19 But I nor go si any oda apostle apart from James, wey bi Jesus Christ broda. 1:20 God dey si wetin I dey rite, bikos evritin wey I dey rite to una so, na true! 1:21 Afta dis, I kon go Siria and Silisia aria. 1:22 But di pipol for di church wey dey Judea, nor know mi. 1:23 Dem only dey hear sey, “Di pesin wey dey trobol us before, don dey prish di message wey e bin dey try to distroy.” 1:24 So dem kon dey praiz God bikos of mi.