Library · pcm

Galatians 5

5:1 Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free. 5:2 Una dey hear so! Mi wey bi Paul dey tell una sey, if dem sekonsaiz una, den Christ nor mean anytin to una again. 5:3 And I dey warn evribody; anybody wey gri make dem sekonsaiz am, must obey evry oda tin wey di law tok. 5:4 Pipol wey wont make pipol know sey dem dey good, bikos dem dey keep di law, dem don already fall komot from God grace. 5:5 Bikos na thru faith for God Spirit, naim wi hope sey, God go make us dey good for en eye. 5:6 For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love. 5:7 Before, una dey do well; but naw, who sey make una nor obey di trut? 5:8 Nor bi God wey koll una sey make una dey do like dis! 5:9 Na small yist dey make bread raiz! 5:10 I get mind sey, God nor go let una listin to anoda pesin. But di pesin wey dey konfuse una, go face judgement, no matter who e bi. 5:11 Naw, my brodas and sistas, if I still dey prish about how dem go take sekonsaiz una, why pipol dey trobol mi? If na so, my tishing about Christ cross nor suppose kause any trobol. 5:12 I wish sey doz wey dey disturb una go-go sekonsaiz demsef! 5:13 My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda. 5:14 Bikos if dem add di whole law togeda, dem go kon bi one kommandment wey sey, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef.” 5:15 But if una kontinue to kworel among unasef; una go fit wound or kill each oda by mistake. 5:16 I tell una, make una let di Spirit direct una life and una nor go do wetin di flesh wont. 5:17 Bikos di tins wey di body like, difren from wetin di Spirit like and wetin di Spirit wont, nor dey gri with wetin di flesh wont. 5:18 But if una allow di Spirit kontrol una, den una nor dey under di law again. 5:19 Na di tins wey di flesh dey do bi dis: To sleep with pesin wey yu nor marry; to get bad mind; to opress pipol; 5:20 to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol; 5:21 bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom! 5:22 But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes, 5:23 gentolness and to kontrol awasef. Di law nor dey against all dis tins. 5:24 Pipol wey dey inside Christ don kill dia flesh with all di bad tins wey di flesh dey like to do. 5:25 If di Holy Spirit dey inside us, den make wi dey live awa life as di Holy Spirit wont. 5:26 Make wi nor dey karry body up and dey do wetin go vex pipol or dey jealous one anoda.