Ephesians 1
1:1 Dis leta na from Paul, wey bi Jesus Christ apostle, bikos na so God wont am. I dey rite to God pipol wey dey for Efesus, di ones wey dey follow Jesus Christ with faith.
1:2 Make di grace and peace wey dey kom from God awa papa and from awa Oga God Jesus Christ, dey with una.
1:3 I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.
1:4 Before God kreate di world, E choose us thru Christ bikos E love us, so dat for en front, wi nor go get any fault and wi go dey holy.
1:5 Before, God don already decide thru Jesus Christ sey, wi go bi en shidren, bikos na so E wont am.
1:6 So, make all praiz and glory bi en own, bikos of en free grace wey E give us, thru en pikin wey E love well-well.
1:7 Na thru Christ blood wi take get salvashon and na dis blood make God dey forgive us awa sins, bikos en grace big well-well.
1:8 Di grace wey E give us, get plenty wisdom, sense and undastandin.
1:9 E do like dis wen E show us di sekret plan wey E get and di good mind wey E show evribody, thru Christ.
1:10 God go komplete en plan wen di time don rish, den E go gada evritin wey dey heaven and eart togeda under Christ, wey bi di head.
1:11 All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,
1:12 so dat wi wey first bilive Christ, go dey gi-am praiz and glory.
1:13 Since una don hear di trut kon bilive Christ, God don give una di Holy Spirit as special mark to show sey naim get una.
1:14 God deposit dis Holy Spirit for di tins wey wi go inherit, until di time wen E go save en pipol, so dat all praiz and glory go bi en own.
1:15 So, since I hear about una faith for Christ and how una love all God pipol,
1:16 I nor dey stop to tank God for una, wen ever I dey pray.
1:17 I pray make God, awa Oga God Jesus Christ Papa wey get glory, give una spiritual wisdom and revelashon, wey go make una know am well-well.
1:18 Una eye don open to undastand di grace wey God koll una kom enter and una don si how di blessing wey E promise en pipol, plenty rish.
1:19 Una don si how en pawa big rish, bikos una bilive am. Dis na di pawa wey dey do big-big tins for us.
1:20 E show dis pawa thru Christ, wen E raiz am from deat, kon make am sidan for en rite hand for heaven;
1:21 di place wey far well-well, wey high pass where wiked pipol dey rule; wey strong pass evry pawa wey dey dis world; big pass evry name wey dey for dis world and di ones wey dey kom.
1:22 God put evritin under Christ leg kon make am head for di church and Oga God for evritin.
1:23 Na di church bi Christ body and naim dey make evritin for evriwhere full and komplete.