Ephesians 3
3:1 Bikos of dis, mi Paul wey bi prisona for Christ, bikos of una wey bi Gentile pipol, dey pray give God.
3:2 True-true, una don hear sey na God give mi dis work thru en grace and na for una own good.
3:3 God open my eye to undastand en sekret, as I rite to una before,
3:4 so dat wen una read am, una go fit undastand di sekret wey God show mi.
3:5 Di pipol wey dey before nor know dis sekret as God don show en holy apostles and profets wey dey naw, thru di Holy Spirit.
3:6 So, bikos of di gospel, Gentile pipol don follow Jew pipol get share for God blessing. Dem don bi membas for Christ body and dem get share for God promise.
3:7 I bi dis gospel savant, bikos of God grace wey E give mi thru di work wey en pawa dey do.
3:8 Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.
3:9 Di grace na to make evribody undastand God sekret plan. Na God kreate evritin and E hide di plan since e kreate di world.
3:10 E make dem undastand, so dat thru di church, all di rulers and pawas wey dey heaven go kon know God komplete wisdom, wey dey show ensef for difren ways.
3:11 Dis happen akordin to en plan wey go stand forever and E make am happen thru awa Oga God Jesus Christ
3:12 and na bikos Christ dey faithful, naim make us get di heart to fit rish where God dey.
3:13 Na dis make mi tell una sey, make una nor fear bikos of di tins wey I dey sofa, bikos na for una own good.
3:14 Bikos of dis, I dey knee down for awa Papa front,
3:15 where all di family for heaven and eart from get dia names.
3:16 I dey pray sey as en glory big rish, E go make una strong well-well with pawa thru en Spirit wey bi di really pesin inside una.
3:17 So dat Christ go dey inside una heart thru faith and wen una don strong well-well inside God love,
3:18 una go fit join all God pipol undastand how God love wide, long, high and deep rish.
3:19 Den una go really know di love wey Christ get, wey big pass evritin wey una go fit undastand and evritin inside God, go full una life.
3:20 So, make all di glory bi God own; di Pesin wey dey do pass di tins wey wi go fit ask or tink, thru en pawa wey dey work inside us.
3:21 Make all glory for Christ church bi en own from one generashon go rish anoda. Amen!