Deuteronomy 3
3:1 Den wi turn kon dey go Bashan and King Og for Bashan kon gada en sojas kom fight us for Edrei.
3:2 But God tell mi, “Make una nor fear, bikos I don give una viktory ova King Og and all en sojas and I go give una all en land. Make una do to am, just as una do to King Sihon for Heshbon town inside Amor.”
3:3 So God make us win King Og for Bashan and all en sojas, den wi kill dem finish.
3:4 For dat time, wi kollect all di towns wey e get. E nor get any town wey wi nor take from dem. Wi take sixty towns and all di aria for Argob wey bi Bashan main kingdom.
3:5 Dem guide all dis towns with high walls, big gates kon lock dem with betta iron key and dem still get many village.
3:6 Wi judge dem well, both wimen and shidren, just as wi judge King Sihon for Heshbon.
3:7 But wi keep all di animal and evry oda tin wey wi karry from di town.
3:8 So for dat time, wi take di two king for Amor land for (Trans-Jordan) go rish River Arnon and Mount Hermon
3:9 (Sidon pipol dey koll am Hermon Sirion, why Amor pipol dey koll am Senir),
3:10 all di towns wey dey di high lands, all di lands for Gilead and Bashan go rish Salekah and Edrei, di towns wey bi King Og for Bashan, own.
3:11 For all Refah pipol, na only King Og for Bashan remain. (Na iron dem take make en bed and e still dey for Rabbah wey dey Ammon. Akordin to how dem dey measure, di bed long rish thirteen and half fit and e wide rish six fit.)
3:12 Dis na di land wey wi kollect den: Di aria from Aroer go River Arnon and half for Gilead hill kountries with dia towns, I give dem to Reuben and Gad tribe.
3:13 Di remainin one for Gilead and di land for Bashan and King Og kingdom, I give dem to half for Manasseh tribe. (All di aria for Argob, dat is, all Bashan wey dem dey koll Refah land.
3:14 Manasseh pikin, Jair take Argob aria go rish Geshur and Maakat pipol borda (wey bi Bashan), den e shange di town name to en name. And na Havvot-Jair dem dey koll am till today.)
3:15 I give Gilead to Makir.
3:16 Di aria from Gilead go rish River Arnon (Di main centre) go rish River Jabbok, wey dey Ammon pipol borda, I still give dem to Reuben and Gad tribe.
3:17 Arabah and Jordan River na still borda for Kinneret Sea go rish Arabah Sea (dat is, di Salt Sea), under di low land for Pisgah go rish di east.
3:18 For dat time, I tell dem sey: “Di Oga wey bi una God don give una dis land as una own. Una sojas wey don ready for war go cross first, before Israel pipol go follow for back.
3:19 But una wifes, shidren and animals (Bikos I know sey dem many), make dem stay for di towns wey I give una.
3:20 Una must fight until God make una pipol win, just as E do for una and dem go kollect di land wey God give dem for di oda side for Jordan River. Den una fit go back to una own land wey I don give una.”
3:21 I still kommand Joshua sey, “Yu don si evritin wey di Oga yor God do to doz two kings; E go still do di same tin to all di kingdoms wey yu go-go.
3:22 So make una nor fear, bikos di Oga una God go fight for una by ensef.”
3:23 So for dat time, I beg God,
3:24 “My Oga God, yu don start to show mi yor pawa and how Yu strong rish. (Na wish god for heaven or eart go fit do wetin Yu dey do so?)
3:25 Abeg make Yu let mi cross with Israel pipol, so dat I go si di land wey Yu promise awa grand-grand papa dem for di oda side for Jordan River, wey get betta kountries for di hill and Lebanon!”
3:26 But God vex for mi, bikos of una and E nor gri listin to mi. Instead, E tell mi, “E don do! Make yu nor tok to mi about dat matter again!
3:27 But klimb go Pisgah and make yu look di east, nort, sout and west well-well, bikos I nor go let yu cross Jordan River.
3:28 But yu go make Joshua di leader kon enkourage am, bikos na-im go take dis pipol cross kon make dem get di land wey yu go si.”
3:29 So wi stay for Bet-Peor Valley.