Library · pcm

Deuteronomy 33

33:1 Dis na di blessing wey Moses, God savant bless Israel pipol before e die: 33:2 “God kom from Mount Sinai and E show ensef to Israel pipol for Seir; E shine kom from Mount Paran and E kom with 10,000 holy ones. Na en rite hand E take give dem en law. 33:3 Yes! God really love en pipol; all doz wey dey holy dey en hand. Dem waka as E dey waka kon do di tins wey E tish dem. 33:4 Moses give us God kommand, di special place wey E keep for en pipol, Israel. 33:5 Na God bi king for Israel wen all di leader among di pipol go gada go meet kon gada all di tribe for Israel as one.” 33:6 Moses pray for Reuben tribe sey: “Reuben tribe go live and dem nor go die, even doh dem nor plenty.” 33:7 Moses pray for Judah tribe sey: “My God, make Yu hear Judah pipol kry kon bring dem togeda as one. Make Yu give dem pawa to take fight and win dia enemies!” 33:8 Moses pray for Levi tribe sey: “My God, Yu don give yor Tumin and Urim to doz wey dey fear and respet Yu. Doz wey Yu don test for Massah kon follow dem kworel for Meribah wotaside. 33:9 Dem tell dia papa and mama sey, ‘Wi neva si am’ and e nor do like sey e know us or en own shidren, bikos dem keep yor word kon guide yor kovenant. 33:10 Dem go tish Jakob yor law kon tish Israel pipol yor kommand: dem go offa betta incense for Yu kon burn good ofrin for yor altar. 33:11 Make wi bless God strent and di work wey E don do; bikos E kill di enemies lion, so dat dem nor go fit raiz at-all!” 33:12 Moses pray for Benjamin tribe sey: “God love Benjamin pipol and dem dey save under am. E dey gada dem from evry side, so dat nor-tin go do dem.” 33:13 Moses pray for Josef tribe sey: “Make God bless una land with rain and with wota wey dey kom from under di groun. 33:14 Make betta-betta fruit wey dey grow under di sun dey una land and di fruit for di sizin go bi una own. 33:15 Make betta fruits kover una hills and mountins. 33:16 Make good tin full una land and na God goodness go bless dem, bikos na-im tok from di bush wey dey burn. Make dis blessing kom meet Josef tribe, bikos na-im bi leader among en brodas. 33:17 Josef get bull strent and wiked melu horn. E go rule pipol kon porshu dem rish di end for di eart. Dis na my blessing for Efraim and Manasseh pipol.” 33:18 Moses pray for Zebulun and Issakar tribe sey: “Zebulun pipol go prosper as dem dey travel. Make Issakar pipol prosper for dia house. 33:19 Dem invite strenjas kon dia mountin kon offa di rite sakrifice for der. Dem get dia money from di sea and di wotaside.” 33:20 Moses pray for Gad tribe sey: “God go bless una wey make en land wide! Gad pipol bi like lion wey won tear pesin hand or head komot from en body. 33:21 Gad pipol take di best land for diasef; dem give dem di leadership. Wen Israel pipol leaders don gada, na Gad pipol dey first obey God kommand and rules for Israel.” 33:22 Moses pray for Dan tribe sey: “Dan pipol bi like yong lion wey dey kom out from Bashan.” 33:23 Moses pray for Naftali tribe sey: “Naftali pipol, favor go follow una and God don bless una well-well; make una kollect di west and sout as una own.” 33:24 Moses pray for Asher tribe sey: “Make God bless Asher pipol pass evry oda sons; make en brodas karry am high and Asher pipol go dey wosh dia own legs with olive oil. 33:25 Una gate key go bi iron and bronze and God go guide una forever. 33:26 Israel pipol, no god bi like una God. E dey kom help una from heaven and di sky with en wonderful pawa. 33:27 Na di God wey go dey forever bi una guide and provida. En hand wey go dey forever, dey support una. E drive all una enemies kon sey make una distroy dem! 33:28 So Israel pipol go stay for peace, Jakob pipol go prosper for di land wey get food and wine and dew go drop from heaven. 33:29 Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”