Library · pcm

Deuteronomy 8

8:1 Make una make sure sey una dey obey all di kommandment wey I dey give una today. Den una go get long life kon many as una enter and stay for di land wey God promise sey E go give una grand-grand papa. 8:2 Make una remember how di Oga una God guide una pass di wildaness for dis forty years, so dat E go fit honbol and test una to si if una go fit keep en kommand or not. 8:3 True-true! E make una dey honbol thru honga kon dey give una food wey una nor know (manna) make una chop. E do dis to tish una sey human being nor nid only food, but dem still dey alive bikos of wetin God tok. 8:4 For dis forty years, una klot nor even tear and una leg nor get sore at-all. 8:5 Make una tink am well. Just as papa and mama dey ponish dia pikin, na so too di Oga una God ponish una for una own good. 8:6 So make una obey di kommand wey di Oga una God give una kon do as E tok and always dey fear am. 8:7 Bikos di Oga una God dey take una enter one betta land; land wey get betta river and wota, with fountain wey dey flow for di valley and hill. 8:8 Betta land wey get wheat, barley, vines, fig trees, pomegranates, olive oil and honey; 8:9 land where una go for chop as una like and una go get evritin. Betta land where stones bi like iron and una go fit make koppa from en hills. 8:10 Una go chop beleful kon praiz di Oga una God, bikos of di good land wey E give una. 8:11 Make una make sure sey una nor forget di Oga una God. Make una dey keep en kommand and law wey I dey give una today. 8:12 Bikos wen una go don get propaty well-well kon build many fine house to stay 8:13 and get many animals and many silva and gold, plus evry oda tin, 8:14 make una nor kon dey do like sey una too important, den forget di Oga una God wey bring una kom out from Egypt where una for bi slaves before. 8:15 Na dis God take una pass di wildaness wey get wiked snakes and skorpions; place where wota nor dey. But God make wota flow for una from rock kon 8:16 feed una for di wildaness with manna (food wey una grand-grand papa nor ever know), so dat E go honbol and test una, den make una betta pipol. 8:17 E do all dis tins, so dat una nor go kon dey tell unasef sey, “Na my own pawa and work, I take get all dis tins.” 8:18 Una must remember di Oga una God, bikos na en dey give pipol di pawa to make money. If una obey am, di kovenant wey E make with una grand-grand papa, E go make am happen for una life. 8:19 But if una forget di Oga una God for evritin kon dey follow oda gods, dey woship and bow for dem, I go tell una today sey, God go really distroy una. 8:20 Just like di pipol wey God won distroy for una, na so too E go do to una, bikos una nor gri follow en kommand.