Library · pcm

Colossians 4

4:1 Una wey bi masta, make una trit una savants well and nor shit dem, bikos una know sey, unasef get masta for heaven. 4:2 Make una dey sirious for una prayer. Make una dey shine una eye as una dey tank God wen una dey pray. 4:3 Like dis too, make una dey pray for us, so dat God go give us betta shance to tok about Christ sekret, wey make mi dey prison. 4:4 Make una pray make I tok well, so dat pipol go undastand mi. 4:5 Make una dey wise as una dey tok with pipol wey nor dey follow Christ. Make una use evry shance wey una get well. 4:6 Make all of una word dey good and sweet like wetin dem put sugar, so dat una go know how to ansa evribody. 4:7 Tikikus, my broda wey I love and awa Oga God savant; wey dey work well-well like mi, go tell una evritin wey dey happen to mi. 4:8 Na bikos of dis I send am kom meet una, so dat una go know how tins bi for us and make e for give una heart. 4:9 Onesimus, di broda wey dey with us, wey wi love well-well, wey bi one of una, I dey send am follow Tikikus. Dem go tell una evritin wey dey happen for here. 4:10 Aristakus, wey follow mi dey prison dey greet una and Mark wey bi Banabas kousin (wey wi bin tell una sey, if e kom meet una, make una welkom am) dey greet una too. 4:11 Jesus wey dem still dey koll Justus, dey greet una. Jew pipol wey bi Christian and dey follow mi do God work, na only dem dey help mi. 4:12 Epafras, wey bi one among una and Christ savant, dey greet una. E dey pray well-well for una, so dat una leg go strong for groun and una go grow as una dey learn di tins wey God wont. 4:13 Bikos I bi witness sey, e don work well-well for una and doz wey dey Laodicea and Hierapolis. 4:14 Awa friend Demas and Luke, wey wi love well-well, wey bi doctor, dey greet una too. 4:15 Make una tell di brodas and sistas wey dey Laodicea, with Nimfa and di pipol wey dey gada for en house sey, I greet dem. 4:16 And afta una don read dis leta, make una let di pipol for di church wey dey Laodicea, read am too. Den make una still read di leta wey I rite give dem. 4:17 Make una tell Arkippus sey, make e finish di work wey Christ gi-am. 4:18 Mi Paul, dey rite dis greetin with my own hand. Make una remember di shains wey dem take tie mi and make God grace dey with una.