1 Thessalonians 3
3:1 Wen wi nor fit bear-am again, wi kon sey wi go stay for Atens by awasef.
3:2 So wi kon send Timoti, awa broda wey dey follow us do God work sey, make e kom enkourage una koncerning una faith,
3:3 so dat nobody among una go dey fear, bikos of all dis sofa. Unasef know sey all wetin dey happen, na as God plan am.
3:4 Wen wi dey with una, wi dey tell una before di time rish sey, wi go sofa well-well and e don dey happen as una dey si am.
3:5 So wen I nor fit bear again, I send pesin make e help mi shek how una faith bi, bikos I dey fear sey devil wey dey tempt pipol, don tempt una and all di work wey wi do among una, don dey yuzles.
3:6 But naw, Timoti don kom meet us afta e si una and e tell us di Good News about di faith and love wey una get. E still tell us sey, una dey always remember and dey hongry to si us, just as wi dey hongry to si una.
3:7 So, awa brodas and sistas, for all awa trobol and sofa, awa heart dey strong about una, bikos of una faith.
3:8 Naw, wi dey alive again, bikos una stand well for Christ
3:9 and wi dey tank God for una. Wi dey tank am for di joy wey wi get for en present bikos of una.
3:10 Wi dey pray with all awa mind for day and nite sey, make God let us si una again kon let una know evritin wey una suppose know about una faith.
3:11 Make God awa papa and Oga God Jesus prepare road for us, so dat wi go si una again.
3:12 Make Christ make una love for each oda and for evribody, grow more-more and big, just as awa love for una bi,
3:13 so dat una heart go dey strong for holiness. And for di time wey Christ go kom with en pipol, una go dey without fault for God present.