Philemon 1
1:1 Na Paul wey bi prisona bikos of Jesus Christ and awa broda Timoti rite dis leta to Filemon, awa dear broda and ko-worker.
1:2 And to Afia awa sista, Arkippus awa fellow soja and di church pipol wey dey meet for en house.
1:3 Make God and awa Oga God Jesus Christ give una grace and peace.
1:4 Evritime wey I remember yu for my prayers, I dey tank my God,
1:5 bikos I don hear about di faith and love wey yu get for awa Oga God Jesus Christ and all God pipol,
1:6 so I dey pray sey di faith wey yu get go make yu undastand all di blessings wey bi yor own inside Christ.
1:7 I get joy and my heart dey strong bikos of yor love and thru yu, all God pipol heart don strong too.
1:8 Since I get strong bilive for Christ sey, I fit tell yu make yu do wetin dey rite,
1:9 mi Paul, wey bi old man and prisona bikos of Christ, won advise yu with love.
1:10 Abeg, make yu dey kind to Onesimus, wey bi my pikin for God work and e dey prison with mi.
1:11 Before, e nor dey yuzful to yu, but naw, e dey yuzful to mi and yu.
1:12 I dey send am kom back kom meet yu (even doh I love am well-well).
1:13 If to sey yu dey here, I for wont make e help mi as I still dey prison bikos of di gospel work.
1:14 But I nor won do anytin wey yu nor go like, so dat di good wey yu do, nor go bi by force, but e go kom from yor mind.
1:15 May bi na bikos of dis make am nor dey with yu since, but naw, e go dey with yu forever.
1:16 Nor bi as slave, but as broda wey wi love, bikos e don big pass slave. E don bikom awa broda naw, bikos God don shange am.
1:17 So, if yu si mi as yor broda and patina, make yu asept am as yu go take asept mi.
1:18 If e tif or whole yu anytin before, make yu tell mi and I go pay.
1:19 Na mi Paul take my hand rite dis leta sey, I go pay back, but I fit still sey, yu yorsef dey whole mi.
1:20 So my broda, make yu do dis tin for mi bikos of Christ, so dat belle go sweet mi.
1:21 I dey sure sey yu go do wetin I ask yu, so I dey rite give yu, bikos I know sey yu go do pass wetin I ask.
1:22 So, make yu prepare where I go stay, bikos I know sey yor prayers go make dem free mi kom meet yu soon.
1:23 Epafras, wey dey prison with mi, bikos of Jesus Christ, dey greet yu.
1:24 Mark, Aristakus, Demas and Luke, wey bi my ko-workers, dey greet yu too.
1:25 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with yor spirit.