Library · pcm

Hebrews 1

1:1 Before-before, God tok to awa grand-grand papa dem for many ways, thru di profets, 1:2 but naw, E dey tok to us thru en pikin wey get evritin and na thru am, E kreate di world. 1:3 Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven. 1:4 E big pass di angels, just as di name wey God gi-am big pass angels own too. 1:5 Na wish angel God tell sey, “Yu bi my pikin, today I don bikom yor Papa?” Or as E tok for anoda place sey, “I go bi yor Papa and yu go bi my pikin?” 1:6 But wen God won send en first-born enter dis world, E sey: “Make all my angels woship am.” 1:7 God tok about di angels sey, “I make my angels and my savants spirit to dey burn like fire,” 1:8 but koncerning en pikin, E sey: “Yu bi God! Yor kingdom go dey forever and ever and yu go rule yor pipol with authority. 1:9 Yu love to do good and yu hate wikedness. So God, wey bi yor God don anoint yu with oil wey dey bring joy and E make yu dey above yor mates.” 1:10 E still tell di pikin sey: “For di biginnin, na God kreate di eart and na with en hand E take make di heavens. 1:11 Dem go skata, but God go dey forever. All of dem go grow kon old like klot 1:12 and like klot and koat, God go fold and shange dem, but God nor dey shange and en life nor go ever end.” 1:13 Na wish angel God tell, “Sidan for my rite hand until I go put all yor enemies under yor leg?” 1:14 All di angels na savants and na dem God send go prish for pipol wey go get salvashon.