Library · pcm

James 3

3:1 My brodas and sistas, evribody nor go fit bi tisha, bikos yu know sey wi wey dey tish, na awa judgement go big pass, 3:2 bikos wi dey make many mistake. If pesin nor dey make mistake for wetin e dey tok, dat mean sey e dey pafet and e go fit kontrol en body. 3:3 If wi tie rope for horse mout make e for obey us, dat mean sey wi dey kontrol en body. 3:4 Look ship for wota: E big well-well and na strong breeze dey fit push am, but na one small wheel di driver dey use take kontrol am. 3:5 Na so di tongue bi too: naim small pass for di body, but di tins wey e fit do big well-well. Make una tink how small fire fit burn big forest rish groun. 3:6 Di tongue na fire! Na der bad tins full pass for pesin body. E dey spoil di whole body and kause fire for pesin life and dis kind fire dey kom from hell. 3:7 Human being dey fit kontrol bird, animal wey dey creep for groun and animal wey dey stay for wota. 3:8 But nobody don ever fit kontrol en tongue well. Di tongue na bad tin wey nor dey stay one place, bikos e get poizin wey fit kill pesin. 3:9 Na di tongue wi take dey praiz awa Papa and Oga God Jesus Christ and naim wi still dey use take curse pipol wey God kreate like ensef. 3:10 My brodas and sistas, na di same tongue wi dey use take praiz and curse pipol. But e nor suppose bi like dat. 3:11 Wota wey dey kom out from groun, nor dey bring out fresh and bitter wota from di same place, abi e dey do so? 3:12 My brodas and sistas, fig tree go fit bear olive, abi vine fit bear fig? So too, wota wey dey kom out from groun and e taste like salt, nor go fit taste like fresh wota at-all. 3:13 Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring. 3:14 But if jealousy and sefishnes dey en mind, make e nor boast and lie against di trut. 3:15 Dat kind wisdom nor kom from God, but e kom from dis eart wey wiked well-well. 3:16 Bikos where jealousy and long-trot dey, wahala and bad tins wey pipol dey do, dey der too. 3:17 But God wisdom dey pure; e get peace; dey gentol; dey asept pipol and good fruit and mesi full am; e nor dey do wayo or pritend. 3:18 Pipol wey nor like trobol, dey plant fruit wey dey bring raitiousness.