Joshua 21
21:1 Di leaders for Levi tribe go meet Eleazar wey bi priest, Joshua wey bi Nun pikin and Israel leaders
21:2 for Shiloh wey dey Kanaan land kon sey, “God tell Moses sey make e give us town wey wi go stay and fields for awa animals.”
21:3 So Israel pipol give Levi tribe towns and fields from dia own, just as God don tok.
21:4 Dem share di first ones give Kohat family. Di Levi wey bi priest Aaron shidren kon get thirteen big towns from Judah, Simeon and Benjamin tribe.
21:5 Di rest for Kohat shidren get ten big towns from Efraim, Dan and half of Manasseh tribe.
21:6 Gershon shidren get thirteen big towns from Issakar, Asher, Naftali and half of Manasseh tribe wey dey Bashan.
21:7 Merari shidren and dia family get twelf big towns from Reuben, Gad and Zebulun tribe.
21:8 So Israel pipol give Levi tribe dia towns and fields, just as God tell Moses.
21:9 From Judah and Simeon tribe, na di towns wey dem give out bi dis.
21:10 Dem give Kohat family from Levi tribe wey bi Aaron shidren, bikos di first share na en own.
21:11 Dem give dem Kiriat-Arba (na Arba bi Anak papa), wey bi Hebron for di hill kountry for Judah, plus di aria wey dey near am.
21:12 (Dem give di fields and di towns wey dey near am to Kaleb wey bi Jefunneh pikin.)
21:13 So for Aaron shidren, di priest kon give dem Hebron (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am), Libnah,
21:14 Jattir, Eshtemoa,
21:15 Holon, Debir,
21:16 Ain, Juttah and Bet-Shemesh, plus all di aria for der.
21:17 From Benjamin tribe, dem give dem Gibeon, Gibeah,
21:18 Anatot and Almon, plus di aria wey dey near der and all of dem na four towns.
21:19 Di priests wey kom from Aaron family kon get thirteen towns, plus di aria for der.
21:20 Di rest for Kohat family for Levi tribe kon get big towns from Efraim tribe and dem bi:
21:21 Shekem (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am) wey dey Efraim kountry for di hill, Geza,
21:22 Kibzaim and Bet-Horon, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
21:23 From Dan tribe, dem give dem Eltekeh, Gibbeton,
21:24 Aijalon and Gat-Rimmon, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
21:25 From half of Manasseh tribe, dem give dem Taanak and Gat-Rimmon, plus all di aria for der and dem bi two big towns.
21:26 Di rest for Kohat family get ten towns and dia aria.
21:27 Dem give Gershon family for Levi tribe dis towns: from half of Manasseh tribe, dem give dem Golan for Bashan (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am) with Beeshtarah, all di aria for der and dem bi two big towns.
21:28 From Issakar tribe, dem give dem: Kishon, Daberat,
21:29 Jarmut and En-Gannim, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
21:30 From Asher tribe, dem give dem: Mishal, Abdon,
21:31 Helkat and Rehob, plus di aria for der and dem bi four big towns.
21:32 From Naftali tribe, dem give dem: Kedesh for Galilee (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am), Hammot-Dor and Kartan, plus all di aria for der and dem bi three big towns.
21:33 Gershon family get thirteen towns and dia aria.
21:34 Dis na di towns wey dem give Merari family (doz wey remain for Levi tribe). From Zebulun tribe, dem give dem: Jokneam, Kartah,
21:35 Dimnah and Nahalal, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
21:36 From Reuben tribe, dem give dem: Beza, Jahza,
21:37 Kedemot and Mefaat, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
21:38 From Gad tribe, dem give dem: Ramot for Gilead (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am), Mahanaim,
21:39 Heshbon and Jazer, plus di aria for der and dem bi four big towns.
21:40 Merari family (doz wey remain for Levi tribe) kon get twelf big towns.
21:41 Levi tribe kon get forty-eight big towns plus dia aria among di land wey bi Israel pipol own.
21:42 All dis towns get betta aria round am and dem resemble well-well.
21:43 So God give Israel pipol all di land wey E promise dia grand-grand papa and dem win am kon dey stay der.
21:44 God dey protet dem, bikos of di promise wey E make with dia grand-grand papa. E nor get any enemy wey fit fight dem.
21:45 So, God do evritin wey E promise Israel pipol.