Joshua 23
23:1 E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well.
23:2 So Joshua gada all di pipol, plus di eldas, rulers, judge and leaders kon tell dem sey: “I don old well-well.
23:3 Una si evritin wey di Oga una God do to di oda nashons and as E take fight for una.
23:4 Di nashons wey still remain, I don give dia land to una tribe, from Jordan River go rish Mediterranean Sea for west, plus all di nashons wey I win.
23:5 Di Oga una God go drive dem komot for una, so dat una go fit stay dia land just as di Oga una God promise una.
23:6 “Make una dey strong! Make una dey obey evritin wey dem rite for Moses book with kare, so dat una nor go fall go left or rite,
23:7 or kon make friend with di remainin nashons. Una must nor use dia god name take make mout or tok about am! Una must nor woship or bow to dem!
23:8 But una must dey loyal to di Oga una God, as una don dey loyal till today.
23:9 “For una front, God porshu nashons wey get pawa well-well; nobody fit beat una kon rish today.
23:10 Only one of una fit make 1,000 pipol run, bikos di Oga una God dey fight for una as E promise.
23:11 Make una dey very kareful! Make una love di Oga wey bi una God!
23:12 “If una turn from God kon go enter agriment with di remainin towns wey dey near una, den marry some of dem and bi friend with some,
23:13 den make una know sey di Oga awa God nor go porshu dis nashons again. Dem go trap and turn una to slave; dem go bi kane wey go dey tear una body kon blind una eyes until una vanish komot from dis good land, wey di Oga una God give una.
23:14 “Make una listin, I go soon die. Una know with all una heart and body sey evritin wey God promise sey E go do, E don do am for us!
23:15 And na so, E don do evritin wey E promise una sey E go do for una, but if una disobey, God go bring all di judgement for una head, until E distroy una from dis good land wey di Oga una God give una.
23:16 If una go against di Oga una God kovenant wey E kommand make una keep kon follow, woship and dey bow to oda gods, God go vex for una well-well and una go kwik-kwik vanish komot from dis good land wey E give una.”