Library · pcm

1 Peter 4

4:1 Since Christ don sofa for us, make wi do like am, bikos di pesin wey sofa for us nor get anytin to do with sin again, 4:2 bikos e don do wetin God wont and nor bi wetin pipol wont. 4:3 Di time wey una dey bihave like unbilivers, don pass. Dat time una live bad life; dey do bad tins; dey drink; dey do anyhow and serve juju. 4:4 Naw, doz unbilivers dey sopraiz and curse una, bikos una nor dey follow dem do bad and wiked tins again. 4:5 For di day wen Christ go judge pipol wey dey alive and doz wey don die, e go ponish dem. 4:6 Na dis make Christ prish di gospel for doz wey don die, so dat even doh e go judge dem as human being, dem go live forever as spirit thru God judgement. 4:7 Di time wen evritin go end don near. So make una dey kontrol unasef and shine una eye wen una dey pray. 4:8 As una dey do so, make una love for each oda dey strong, bikos love dey kover plenty sins. 4:9 Make una welkom pipol for una house without komplain. 4:10 God don give evribody en own gift, so make una use di gift take help each oda as good savant wey get God grace. 4:11 Pesin wey dey prish; make e prish God word well. Pesin wey dey help odas, make e do am with di pawa wey God gi-am, so dat for evritin, God go get glory thru Jesus Christ. Make all glory and pawa bi Christ own forever and ever. Amen! 4:12 My friends, make una nor sopraiz sey una dey pass thru trobol like pesin wey fire dey burn, bikos tins wey go make una fear, go must happen. 4:13 Instead, make una dey happy as una dey sofa for Christ, so dat wen God go show una en glory, belle go sweet una. 4:14 If dem curse una bikos of Christ, God don bless una bi dat, bikos God Spirit wey get glory, rest on-top una life. 4:15 But make anybody among una nor sofa, bikos e kill, tif or curse trobol. 4:16 But if yu sofa bikos yu bi Christian, make yu nor shame, but dey praiz God, bikos yu dey ansa Jesus name. 4:17 Di time for judgement don rish and e go start with God pipol. And if e start with us, wetin go happen to pipol wey nor dey obey God? 4:18 If e go hard for God pipol to dey save, den e nor go eazy for doz wey nor dey fear God. 4:19 So if yu dey sofa as God wont am, make yu trust God wey kreate yu and E nor go ever fail yu.