Revelation 13
13:1 Den I si one beast dey kom out from di sea. E get ten horns, seven head and ten crowns dey en horns. For en head, name wey dey curse God, naim dem rite put.
13:2 Di beast wey I si, bi like leopard, but en leg bi like bear leg and en mout bi like lion own. Di dragon kon gi-am pawa, en throne and strong authority to rule.
13:3 One for di beast head bi like wetin dem wound well-well, but di wound don go. Di whole world dey sopraiz kon dey follow di beast.
13:4 Dem dey woship di dragon, bikos na-im give di beast pawa to take rule. Dem dey woship di beast sey, “Who bi like di beast? Na who fit follow am fight?”
13:5 Dem give di beast mout wey dey tok bad-bad words. Di beast dey curse God and e rule for forty-two monts.
13:6 So di beast open en mout dey curse God, en name, where E dey stay and doz wey dey heaven.
13:7 Satan gi-am pawa to fight with God pipol and to win dem. E still gi-am authority to rule evry tribe, group, language and kountries.
13:8 Evritin for dis eart go woship am, even doz wey dia name nor dey for God Lamb book wey get life.
13:9 If anybody get ear, make e hear!
13:10 Anybody wey dem suppose to katch, dem go katch am. Anybody wey swod go kill, dem go kill-am with swod. So, God pipol must bear well-well and get faith.
13:11 Den I si anoda beast dey kom out from groun. E get two horns like small sheep own, but e dey tok like dragon.
13:12 E kollect all di pawa wey dey make di eart and evribody woship di first beast (wey en big wound don go).
13:13 E dey do big mirakles and e even dey send fire kom down from heaven for di pipol front.
13:14 E deceive di pipol for dis eart with di mirakles wey e dey do for di beast front and e tell di pipol sey, make dem make one image for di beast (wey wound before, but still dey alive).
13:15 Di sekond beast still get pawa to give life to di first beast image, so dat e go fit tok and kill doz wey nor gri woship di first beast image.
13:16 E still sey, make evribody, weda small or big, rish or poor, free pesin or slave, kollect di beast mark for dia rite hand or fore head
13:17 and make nobody buy or sell anytin, unless e get di beast mark, nomba or name for en body.
13:18 Dis one nid wisdom; make di pesin wey fit undastand kount di beast nomba: bikos na human being nomba e bi and di nomba na six hundred and sixty six.