Judges 2
2:1 God angel komot from Gilgal go Bokim kon tell Israel pipol, “Na mi bring una kom out from Egypt kon put una for dis land wey I promise to give una grand-grand papa and I tok sey I nor go break my promise with una.
2:2 I sey make una nor make kovenant with di pipol wey dey dis land and make una distroy dia altar, but una nor do wetin I tell una. ‘Wetin make una do like dis?’
2:3 For dat time, I tell una sey, if una disobey mi, I nor go drive di pipol wey dey stay for una land komot again. Dem go bi wahala to una and dia god go dey sweet una to serve.”
2:4 Wen God angel don tok to Israel pipol finish, all of dem kon dey kry.
2:5 So dem koll di place Bokim (wey mean “Cry”) kon offa sakrifice give God.
2:6 Afta Joshua don sey make di pipol dey go, each tribe komot go take di land wey dem divide for dem.
2:7 So thru-out Joshua time, Israel pipol serve God and even afta e don die, dem still kontinue to dey serve am, since di leaders wey si all di good-good tins wey God do for dem still dey alive.
2:8 Joshua wey bi Nun pikin, God savant, die wen e bi one hundred and ten years.
2:9 Dem beri am for en land wey dey Timnat-Heres, for Efraim hill kountry, near di nort side for Mount Gaash.
2:10 Afta dat generashon die finish, di next generashon forget God and evritin wey E don do for dem.
2:11 Israel pipol sin against God and dem kon start to serve one juju wey dem dey koll Baal.
2:12 Dem forget di Oga wey bi dia grand-grand papa God wey bring dem kom out from Egypt kon bigin follow and woship di pipol wey dey around dem, gods.
2:13 Dem forget God kon dey serve Baal and Ashtoret image.
2:14 Bikos of dis, God vex well-well for dem, so E let tif karry all wetin dem get. E allow dia enemies opress dem and dem nor fit protet demsef again.
2:15 Anytime wen Israel pipol go fight war, God dey-dey against dem, just as God tok before and dem sofa well-well.
2:16 Den God give Israel pipol leaders wey kom save dem from dia enemies hand.
2:17 But dem nor still listin to di leaders, instead dem still dey serve and woship oda gods and dem nor do like dia grand-grand papa wey obey all God kommand.
2:18 As long as di leaders wey God give di pipol dey alive, E help and diliver dem from dia enemies. God sorry for dem well-well wen dem kry to am with pain, bikos of wetin dia enemies dey do dem.
2:19 But anytime di leaders die, dem go-go kontinue di bad-bad tins wey dem dey do. Dia own kon even worse pass di ones wey dia grand-grand papa do. Dem follow oda gods; dey serve and woship dem; dem nor gri stop dia sturbones and dem still dey do bad-bad tins.
2:20 So, God vex well-well for dem kon sey, “Bikos dis pipol don break my kovenant wey I make with dia grand-grand papa and forget my kommand,
2:21 I nor go drive any of di nashon wey Joshua nor fit win before e die.
2:22 I go use am take test dem weda dem go follow mi, just as dia grand-grand papa do.”
2:23 Na dis make God leave di nashons for der. E nor drive dem komot or allow Joshua win all of dem.